- Naso di fifth angel blow hin trumpet, I con see one star wey dey fall from di sky enta earth. Dem give di star di key of di deep- pit.
- Wen he open di deep-pit, smoke raise from am—like di smoke from heavy faya. Di smoke from di deep-pit con make di sun and di sky dark.
- And locust enta di earth from di smoke, and dem get pawa like scorpions wey dey for earth.
- Dem tell dem make dem no wound di grass of di earth, or any plant or tree, but only those pipo wey no get Baba-God mark for dia forehead.
- Dem no give dem pawa to kill di pipo, but only to show dem pepper for five months. And di pain wey dem suffer be like wen scorpion bite pesin.
- For those days, men go dey fyne death, but death go fashi dem. Dem go like to kpeme, but death go jakpa.
- And di shape of locusts be like horse wey don ready for fight. Dem wear sometin like crown of gold for dia head, and dia face be like man face.
- Dia hair be like woman hair, and dia teeth be like lion teeth.
- Dem wear fighting- cloth like fighting-cloth wey dem make wit iron, and di sound of dia feathers be like di noise of plenty horse, and horse-moto wey dey rush go fight.
- Dem get tails like scorpion, dia tail dey nack pesin like scorpion, and dia tail get pawa to show pipo pepper for five months.
- Di angel of di deep-pit nahin be dia king. Hin name for Hebrew na Abaddon, and for Greek, na Apollyon.
- Di first yawa don gas; di second and third yawa go soon come.
- Di sixth angel blow hin trumpet, and I con hear one voice dey halla from di four horns of di golden altar—wey dey for Baba-God front.
- And di voice tell di sixth angel wey carry di trumpet sey, “Release di four angels wey dem tie for di great river of Euphrates.”
- And dem release di four angels wey dem prepare for di hour, day, month, and year—to kill one third of di pipo for earth.
- Di numba of di sojas on top of horse na two hundred million. I hear dia numbas.
- Di horses wey I see for my vision, be like dis: Dia riders wear fighting-cloth wey red like faya, dark blue, and sulfur yellow. Di horse head resemble lion head, and faya, smoke and sulfur dey komot from dia mouth.
- One third of di pipo for earth con kpeme, di faya, di smoke, plus di sulfur wey come out from di mouth of di plenty horse—kill dem.
- Di pawa of di horse dey for dia mouth, and dia tail. Dia tail be like snakes—e get head wey dem dey use wound pipo.
- Di remaining pipo wey no die from dis kasala—still no gree repent from di bad tins wey dem put hand, so dat dem no go worship bad-spirits, plus idols of gold, silver, bronze, stone and wood—idols wey no fit see, hear, or waka!
- Dem no gree repent from dia killings, witch [kpians], anyhow- sex or dia tiff-tiff.
Post Views: 32