Zechariah Chapter 2
One Man Wit Line [Rope] For Measurement
- So I look up, and I con see for my front—one man wit line [rope] for measurement for hin hand.
- I con ask am sey, “Where you dey go?” So he ansa me, “I dey go measure Jerusalem, so dat I go know as e long and wide reach.”
- Naso di angel wey dey follow me tok, con carry-go, and anoda angel go meet am,
- con tell am sey: “Run, go tell dat young man sey, ‘Jerusalem go brekete wit pipo plus animals—sote space no go dey, and plenty pipo go live for outside di wall of di city.
- And me mysef go be wall of faya round am,’ naso Baba- God tok, ‘And na me go be di levels inside am.’”
Zion Go Save
6. “Come! Come! Run komot from di land of di north,” naso Baba-God tok, “Becos I don scata una to di four breeze of heaven,” naso Baba-God tok.
7. “Oh Zion, stand up! And make una escape, una wey dey stay wit di daughters of Babylon.”
8. Becos dis na wetin Baba-God Almighty tok: “He don send me for hin levels, against di nations wey don rob una—becos any pesin wey touch una, don touch di apple of Hin eye—
9. I go surely raise my hand against dem—sote dia slaves go rob dem. Den una go know sey Baba-God Almighty don send me.
10. “Sing and make una dey happy, oh pipo of Zion, becos I dey come, and I go live among una,” naso Baba-God tok.
11. “Many nations go gum-body wit Baba-God on dat day, and dem go turn to my pipo. I go live among una, naso una go sabi sey Baba-God Almighty nahin send me to una.
12. Baba-God go claim Judah as hin portion for di holy land, and he go choose Jerusalem again.
13. Dey silent for Baba-God front, everi human being, becos he don raise up from hin holy place!”