1st Chronicles Chapter 13
David Carry Di Ark Come Back
- David reason wit di commanders of thousand sojas, plus di commanders of hundred sojas, plus all di leaders.
- He con tell all di pipo of Israel wey gada sey, “If e dey right for una, and if na di will of Baba-God awa Oga, make we send message go far-far to di rest of awa brodas tru-out di whole areas of Israel, and even to di priests plus di Levites wey dey wit dem for dia own cities and farmlands—make dem come join us.
- And make we carry Baba-God Ark come back to meet us, becos we bin fashi am wen Saul be king.”
- Di whole pipo agree to do dis tin, becos all di pipo feel sey na di right tin to do.
- So David gada all di pipo of Israel, from Shihor River for Egypt go reach di front of Lebo Hamath (for di north)—to bring back Baba-God ark from Kiriath-Jearim.
- So David plus all di pipo of Israel wey dey wit am go Baalah of Judah (Kiriath-Jearim) to bring back di Ark of Baba-God di Oga, wey dey sidon between di cherubim—di Ark wey dem dey call by hin name.
- Naso dem carry Baba-God Ark from Abinadab house wit new truck [wey dem tie join malu], con carry am from Abinadab house. Uzzah plus Ahio nahin dey guide di truck.
- David plus all di pipo of Israel dey celebrate wit all dia full pawa for Baba-God, wit songs plus (music instruments) harps, lyres, sheke-sheke, cymbals plus trumpets.
- Wen dem reach di harvest ground of Chidon, di malu wey dey drag di truck almost fall, and Uzzah use hin hand take hold di Ark.
- Baba-God con vex like faya for Uzzah, and he nack am for ground, becos he put hin hand on di Ark. So he die for there for Baba-God front.
- Naso David no con happy, becos Baba-God use vex kill Uzzah, and dem dey call di place Perez Uzzah till today.
- So David con dey fear Baba-God dat day, and he ask, “How I go take carry Baba-God Ark come house to meet me?”
- So he no carry di Ark follow-body wit am go di City of David. Instead, he carry am go Obed-Edom house—wey be Gittite.
- Baba-God Ark con dey wit di family of Obed-Edom for hin house for three months, and Baba-God bless hin family plus everitin wey he get.