Job Chapter 3
Job Complain To Baba-God
- Afta dis, Job open hin mouth, con curse di day wey hin mama born am.
- Job yarn, con tok sey,
- “Make di day wen dem born me kpeme, and di night wey dem tok sey—‘Dem don born baby boy’.
- Make dat day be darkness, make Baba-God from up-up no-send dat day, and make light no shine upon dat day.
- Make darkness and shadow of death stain am. Make cloud dey on top of am; make di blackness of di day make am fear.
- I wish sey darkness carry dat night komot. Komot dat night from di days of di year and make dem no count am join di numbas of di months.
- See, make dat night dey lonely, con empty, make dem no hear any sound of happiness dat night.
- Make pipo wey sabi curse days—curse dat day, those wey dia words fit control whale.
- Make di stars of di night dark, make e fyne light, but make e no see am; and make dat night no ever reach morning.
- Becos e no gree close di doors of my mama belle, or hide sorrow from my eyes.
- Why I no die from my mama belle, why I no kpeme wen I komot from my mama belle?
- Why dem put me for my mama lap? Or why she make me suck breast?
- Becos now, I for just dey one quiet place, I for sleep; den I for rest.
- I for rest wit di kings of di world, plus di leaders wey dia big-big-houses don scata.
- Or wit princes wey bin get gold, wey dey full dia houses wit silver:
- Why e no be sey I die inside my mama belle, and dem bury me; like pikin wey no live to see di light?
- For there evil pipo no dey cos wahala, and pipo wey don taya dey rest for there.
- Na for there di prisoners dey rest togeda; dem no dey hear di voice of di pipo wey dey oppress dem.
- Both big and small dey for there, and di servant free from hin oga.
- Oh, why you dey give light to di pipo wey sad, and to di pipo wey dey feel pain?—
- pipo wey dey fyne death, but death no gree show-face, con dig for death pass pesin wey dey dig for gold plus silver,
- wey dey celebrate well-well and dey happy, wen dem fit see grave?
- Why we get life if we no get future, and why we get life if Baba-God surround us wit suffer-head from everi corner?
- I no fit chop becos I dey cry, and my cry dey rush down from my eyes like water.
- Becos di tin wey I dey fear well-well—don show-face to me, and di tins wey bin dey make my mind cut—don catch me.
- I no get peace, and I no dey rest, I no dey quiet; but na only palava I dey see.