Job Chapter 6
Job Ansa
- But Job ansa con tok sey,
- “If dem fit calculate my sadness, and dem fit put my palava for scales.
- Becos now, dem for heavy pass sand-sand wey dey for big-river; nahin make me tok any how.
- Becos Baba-God arrows dey for my body, my spirit dey drink dia poison. Baba-God kasala don line up against me.
- Abi wild donkey dey cry wen e dey chop grass? Abi malu dey halla wen dem see food chop?
- Abi pesin fit chop food wey no get taste wit no salt? Abi di white of egg get any taste?
- I no fit touch dem, dat kain food dey make me sick.
- How I wish sey I fit get wetin I ask for, and sey Baba-God fit give me di tins wey I want!
- Even though e go make Baba-God happy to scata me; sey he go loose hin hand from me, con cut me komot!
- Na den I for get sometin to cool me down? Yes, I go get strong mind for inside my serious pain, sey I neva deny or change di words of di Holy One.
- Wetin be my pawa wey go make me get hope? Wetin go happun to me las-las—wey go make me con dey endure?
- Abi my strength na di strength of stones? Abi na brass dem take make my body?
- Abi I no fit epp mysef, and success plus wisdom don komot from me?
- “Pesin suppose show kindness to hin padi wey dey suffer, so dat he no go fashi di fear Baba-God Almighty?
- But my brodas, una don confam to me sey I no fit depend on una—just like river wey dey dry wen rain stop to dey fall,
- wey dey dark becos of ice, and snow wey dey melt.
- But wen hot weather go show-face, di water go stop to dey flow. Di river go vanish for di heat.
- Naso di travellers wey dey travell for di road go turn, dem go lose for inside desert as dem dey fyne water.
- Di travellers of Tema fyne water, di travellers of Sheba hope for dem.
- Dem bin dey put mind on am, but e disappoint dem; dem reach there but dem lose hope.
- Una sef no give me any epp. Una don see my gbege and fear catch una.
- Abi I don ever ask una for gift before? Abi I don ever beg una for anytin wey belong to una?
- Abi I don ever ask una to save me from my enemy hand? Or save me from di hands of evil men?
- Teach me and I go hold my tongue; and make me understand where I don do wrong tin.
- Truth dey pain, but who una argument epp?
- Abi una dey tink about correcting my words, di words of hopless man –words wey be like breeze?
- Una fit sell pesin wey no get papa, or sell una padi.
- Abeg make una look me! Abi I go lie for una front?
- Make una stop to dey reason sey I don do bad, becos I neva do any wrong tin.
- Abi una tink sey I dey tok lie? Abi my taste no fit understand bend-bend tok?