Job Chapter 8
Bildad Tok For Baba-God
- Bildad di Shuhite con ansa sey,
- “How long you go dey tok dis tins and how long di word wey dey komot from your mouth go be like strong-breeze?
- Abi Baba-God dey bend hin judgement? Abi di Almighty Baba-God dey bend justice?
- If your pikin don sin against am and he don komot dem becos of dia bad-bad ways;
- If you go fyne Baba-God sharp-sharp, and make your prayer request to Baba-God Almighty;
- If you pure and your way clean, surely now, he go wake up for you, con give you back di place of your goodness.
- Even though your starting bin dey small, las-las you go prosper well-well.
- Just ask di generation wey bin dey before now. Look and reason wetin dia ancestors experience.
- (Na just yesterday dem born us and we no sabi anytin, becos awa days for di earth be like shadow).
- But those wey come before us go teach you. Dem go teach you di wisdom from dia hearts.
- “Abi papyrus fit grow tall for where no be water-land? Abi reed fit grow for where water no dey?
- As dem still dey grow flower and wen dem neva cut am, e dey dry before any oda plant.
- Naso di way of everi pipo wey fashi Baba-God be, and fake-pipo hope go kpeme.
- Dia hope go cut komot, and dia trust go be like spider web.
- He go rest body for hin house, but e no go stand: he go hold am thight, but e no go fit stand gidigbam.
- He dey grow like green for front of di sun, and hin branches dey spread for inside hin garden.
- Hin root go wrap around plenty stones; and he dey fyne house among di stones.
- But wen dem komot evil pipo root, e go be like sey dem bin no dey before!
- Na dis be di happiness wey evil pesin get, and odas go grow from di earth to take hin place.
- See, Baba-God no go pursue perfect man komot, and he no go epp pipo wey dey do evil tins:
- Until he full your mouth wit laff and your lips wit singing.
- Pipo wey hate you go wear shame for body like cloth, and wicked pipo house go turn to notin.