Job Chapter 10
Job Beg Baba-God
- My soul don taya for my life, make I complain as I like. I go tok as my soul dey bitter me.
- I go tell Baba-God sey, “No condemn me, show me why you dey fight wit me.
- Abi e make sense sey you dey oppress, sey you dey hate di work wey your hand don do, and you dey smile on di plan of wicked pipo?
- Abi your eyes na man eyes? Abi you dey see as man take dey see tins?
- Abi your days be like di days of man? Abi your years be like di days of man,
- wey you con dey fyne di bad-bad-tins wey I don do, and wey you dey look for my sin?
- You know sey I no be wicked pesin, and no pesin fit save me from your hand.
- Your hands nahin make me, con design everi part of my body, but you dey scata me.
- I dey beg you, remember sey you make me like clay—abi you go turn me back to dust again?
- Abi you no pour me like milk for my mama belle, con form me like cheese?
- Naso you form my bones and muscles togeda, con wear skin and flesh for my body.
- You don give me life plus favour, and your care nahin keep my spirit.
- Na dis tins you hide inside your heart: I know sey dis tin dey inside your mind;
- you dey mark me if I commit sin, you no go forgive my sins.
- Wahala for me if I be wicked pesin, and if I be pesin wey get clean-heart—I no go still raise my head up. Disgrace nahin full my life; look my suffer-head.
- My suffer-head dey burku more-more. You dey hunt me like lion wey dey ginger; and again you go show your ogbonge pawa against me.
- You dey bring new witness against me, and you dey vex for me more-more. Changes and war dey against me.
- So why you bring me come out from my mama belle? I wish sey I kpeme and no pesin see me!
- I for dey like sey I no bin dey, dem for carry me enta grave from my mama belle.
- Abi my life no short? Komot from me, leave me joor—so dat I fit rest small,
- before I go where I no go fit come back again—to di land of darkness, and di shadow of death;
- Land wey darkness dey, land wey be darkness esef; di land of di shadow of death, where katakata dey, and where di light na darkness.”