Job Chapter 12
Job Ansa
- So Job ansa, con tok sey,
- “No be lie, na una sabi everitin abi? And wen una kpeme, wisdom go kpeme wit una!
- But I get understanding as una sef get, my level no low pass una own, yes, who no know all dis tins?
- All my padi dey use me laff, even though I dey call Baba-God and he dey ansa. Me wey get clean-heart and wey get clean-hand nahin dem dey laff.
- Pipo wey dey live in peace dey yab pipo wey dey for inside wahala; as di destiny of those wey dia legs wan fall dem.
- Di house of robbers dey prosper, and di pipo wey dey make Baba-God vex dey safe; and Baba-God dey put yanfu-yanfu for dia hand.
- But ask di wild animals now, and dem go teach you, and di birds of di sky, and dem go tell you.
- Or follow di earth tok, and e go teach you, and di fishes for water go tell una.
- Who no know all dis tins sey na Baba-God hand do am?
- For hin hand nahin di soul of everitin wey dey alive dey, and di breath of everi human being.
- Abi ear no dey test words as tongue take dey taste food?
- Na senior-pipo get wisdom, and understanding dey come wit long life.
- Nahin get wisdom and strength, nahin get beta advice plus understanding.
- See, he dey break tins down and dem no fit build am again. He dey lock man up [for prison], and di man no fit free again.
- See, he dey hold di water, and dem go dry kpatakpata. He dey send dem come out sef, and dem go cover di earth.
- Nahin get strength plus wisdom, nahin get both di pesin wey dey play wayo and di pesin wey dem dey play wayo for.
- He dey komot di wisdom of leaders, and he dey turn judges wey get sense to mumu pipo.
- He dey komot kings cloth, con carry dem komot wit rope round dia waists.
- He dey let enemies carry princes komot wit all dia properties, and he dey overthrow strong pipo.
- He dey close di mouth of advisers wey dem trust, and he dey komot di understanding of senior-men.
- He dey disgrace princes, and he dey komot di pawa of strong men.
- He dey show deep tins from inside darkness, and he dey bring di shadow of death come light.
- He dey make nations great, and he dey scata dem: he dey make di nations grow, and he dey carry dem komot as prisoners of war.
- He dey komot di sense plus understanding from leader of di pipo of di earth, and he dey make dem waka inside desert—where road no dey.
- Dem dey waka for darkness like blind pipo wit no light, and he make dem stagger like man wey don high.