Job Chapter 17
Job Kontinu To Defend Hin Pure-heart
- My spirit don break, my days don dey finish kpatakpata, grave don ready for me.
- Abi pipo wey dey yab me no dey wit me? Abi my eyes no still dey look as dem dey make me vex?
- “Oh Baba-God, you must defend me becos I get clean-heart, since na only you fit stand for me.
- Becos you don hide dia heart from understanding, so you must let dem know sey dem dey wrong.
- Pesin wey betray hin padi [becos of wetin he go gain]—make even di eyes of hin pikin close.
- “Baba-God don make di pipo dey laff me, and dem dey spit for my face.
- My eyes sef don dey close becos of sadness, and everi part of my body be like shadow.
- Men wey get clean-heart go shock for dis mata, and innocent men go ginger demsef against fake-pipo.
- Pesin wey get clean-heart go hold hin way kamkpe, and pesin wey get clean-hands go strong more-more.
- But as for all of una, make una come back come try again, becos I no see any wise man among una.
- My days don pass, my plans don break komot—even di tins wey I wish for my heart.
- E con be like sey night na day for me; di light dey short becos of darkness.
- My only hope na di world of di dead, where I go lie down, con sleep inside darkness.
- I don tell grave sey—‘Na you be my papa,’ con tell worm sey, ‘Na you be my mama plus my sista.’
- And where my hope dey now? As for my hope, who fit see am?
- My hope go follow me go down to grave, and we go rest togeda for dust.”