Job Chapter 21

Abeg share

Job: Baba-God Go Punish Wicked Pipo

  1. But job ansa, con tok sey,
  2. “Make una hear me well, na di only tin wey una fit do to make me cool down.
  3. Make una just let me tok, and afta I don tok finish, una fit kontinu to dey yab me.
  4. As for me, abi my complain na to man? And if na so e be, why my spirit no go dey worry?
  5. Make una look me, and make una shock. Put your hand for your mouth wit surprise.
  6. Wen I tink about wetin I dey tok, e shock me, and my body dey shake.
  7. Why wicked pipo dey live long, and dem dey prosper wit pawa?
  8. Dia pikin stand gidigbam as dem dey see dem, and dia pikin dey grow for dia front.
  9. Dia house dey safe from fear, and Baba-God no dey punish dem wit gbege.
  10. Dia malu dey always born. Dia malu dey born pikin and dem no dey lose dia pikin.
  11. Dia pikin dey play upandan like sheep-pikin,
  12. dem dey dance di music of sheke-sheke and harp [music instrument wey ge strings], and dem dey dance to di sound of flute.
  13. Dem dey spend dia days like ajebuta, and dem go enta grave wit peace.
  14. So wicked man go tell Baba-God sey, ‘Komot from us becos we no wan sabi your ways.
  15. Who be di Almighty wey we go dey serve am? And wetin we go gain if we dey pray to am?’
  16. Dem dey claim to succeed wit dia own pawa; but I no fit follow dia way of reasoning.
  17. How many times wicked pipo light dey ever off? How many times kasala ever burst on any one of dem? Abi Baba-God don ever scata wicked pipo or punish dem wit palava as he dey vex?
  18. con blow dem komot like chaff for breeze? Or like dust wey heavy-breeze dey blow komot?
  19. Una go tok sey, ‘See, Baba-God go punish di pikin for dia papa sins!’ But make Baba-God punish di pipo wey do bad bad tins, so dat dem go fit understand hin judgement.
  20. Hin korokoro eyes go see as he go take scata, and he go drink inside di vex of Baba-God Almighty.
  21. Abi he go care about wetin happun to dia family afta dem don die—wen di numba of hin months don cut komot?
  22. Abi any pesin fit teach Baba-God anytin? As una dey see sey he dey judge pipo wey get levels.
  23. Some pipo go strong till dem die, dem dey die as happy pipo wit peace,
  24. Wit hin fresh body, and hin bones strong and fresh.
  25. And anoda man go die wit sadness inside hin spirit, and he no get chance to chop-life.
  26. Naso dem go lie down togeda for dust, and worms go cover dem.
  27. See, I know una tinking, and di wrong tins wey una dey reason against me.
  28. Una tok sey, “Where di prince house dey now, and where wicked pipo house dey now?”
  29. Una neva ask di pipo wey dey travel around? Abi una no reason wetin dem yarn?
  30. See Baba-God dey keep wicked pipo for di day of scata-scata, and dem go dey to face di day wen Baba-God dey vex?
  31. Who fit tell am face-to-face, sey wetin he dey do no good, or pay am back for everitin wey he don do?
  32. But he go enta grave, for grave wey dem dey guard.
  33. Plenty pipo go follow di pipo wey dey go bury am, and di ground for bottom-of-di-mountain go happy to cover hin body.
  34. How una wan take cool me down wit empty words, since una ansa no be true?”

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *