Job Chapter 37
Baba-God Works Plus Hin Wisdom
- Dis tin make my heart cut, and my heart jump from my chest.
- Listen well-well to di thunder of hin voice, and di sound wey dey komot from hin mouth.
- He send hin lightning under di whole heaven, con send am to di ends of di earth.
- Afta am, one voice con sound, e halla wit king voice. And wen hin voice dey sound—he no dey stop di lightning.
- Baba-God voice dey halla like thunder wit elele, and he dey do ogbonge tins wey we no fit understand.
- He dey tell snow sey, “Fall for earth,’ and both di small rain plus big rain of Hin pawa.
- He stop everi pesin from dia work [wit strong weather], so dat everi pesin wey he don make go sabi Hin work [sey dem dey under hin Almighty pawa].
- Naso di wild animals go hide for dia joint, con kpanji for dia place.
- Di rollig-breeze dey come from di south, and cold dey come from di north.
- Baba-God breath dey form ice, and di big water go freeze.
- He dey load di thick clouds wit water and di clouds dey scata hin lightning.
- And dem dey move around as he dey direct dem: so dat dem go do anytin wey he tell dem to do for di face of di whole earth.
- He dey bring di cloud to punish pipo, or to water hin land, or show hin love.
- Listen to dis tin, oh Job; stop and make you reason di ogbonge works of Baba-God.
- Abi you sabi how Baba-God take dey control di clouds, and how he take dey make di lightning of hin clouds flash?
- Abi you know how di clouds take dey balance for air—di ogbonge work of Am wey sabi finish?
- Why your cloth dey hot, wen he make di earth quiet wit di breeze from di south?
- Abi you fit join am to spread out di sky, so dat e go shine wit heat like bronze mirror?
- Tell us wetin we go yarn Baba-God, we no fit argue awa case becos awa minds dey for inside darkness [wetin we sabi na darkness for were Baba-God dey].
- Abi dem go tell Baba-God sey I wan tok? Abi man fit tok wen he dey confused?
- We no fit look di sun, becos e dey shine well-well for sky wen breeze don sweep di cloud.
- [Cloud wey dey shine like gold dey come from di north] fair weather dey come from di north, ogbonge levels as king dey around Baba-God.
- Awa mind no fit reason Baba-God Almighty pawa; but even though he get plenty justice and he good, he no dey oppress pipo.
- No wonder men dey fear; he no dey respect any pesin wey dey feel-big sey dem wise for dia own heart.”