Psalm Chapter 36

Abeg share
  1. Oracle dey for my heart about wicked pipo sins. Di fear Baba-God no dey dia
    eyes at all.
  2. for hin own eyes, he dey tok beta tins about hin sef.
  3. Wetin he dey yarn na evil and wayo; dem no like wisdom or like to do good
    tins.
  4. Dem even dey plan evil ontop bed; e don shuuk hand for evil runs.
  5. Your love, Oh Baba-God, dey reach heaven, your faithfulness dey reach sky.
  6. Your righteousness be like big mountains, your justice be like great deep. Oh
    Baba-God, na you dey protect men and beast.
  7. Moni no fit buy your love wey no dey fail! Bigmen and poormen dey hide under
    the shadow of your wings.
  8. Dem dey chop belleful for di yanfu-yanfu wey dey your house; you dey give
    dem drink from di river wey you like.
  9. Na inisde you di fountain of life dey; na your light dey show us road.
  10. Dey continue to show your love to those pipo wey know you, and your
    righeousness to pipo wey dey get clean heart.
  11. Make proud men no match me for ground, or make wicked pipo hand drive
    me comot.
  12. See as wicked pipo don fall down for ground—dem dey for ground and dem
    no go fit stand up again!

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *