Psalm Chapter 57
- Sorry for me, Oh Baba-God, sorry for me, na inside you my soul dey hide put. I
go hide for under di shadow of your wings until wahala waka pass.
- I cry out to you Baba-God Most High, I cry to Baba-God wey dey fufill hin plan
for my life. - From dey send from heaven and he save me, he change am for those pipo wey
dey pursue me like fire. Baba-God send hin love and faithfulness. - I dey for middle of lions; I dey sleep for where wild animal dey—men wey get
teeth like spear and arrow, men wey dia tongue sharp like sword. - Make your level high, Oh Baba-God, pass di heavens.
- Dem throw net for my leg—I fall wit pain. Dem dig hole for my road—but na
dem con fall inside di hole. - My heart dey for you, Oh Baba-God; I go compose music sing for you.
- Soji, my soul!
Wake up, harp and lyre!
I go wake for morning up. - I go praise you, Oh Baba-God, among di Nations; I go sing about you for among
di pipo. - Your love brekete from here reach heaven; your faithfulness reach sky.
- Make your level rise, Oh Baba-God, pass heaven; make your glory full di earth.
Questions about Psalm 57
What is Psalm 57 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 57 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-57/
Where can I read Psalm 57 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 57 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-57/
Which Bible book contains Psalm 57?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 57?
The chapter identified by this reference is 57.
Topics connected to this passage
- Love
- Salvation
- Worship