Psalm Chapter 58
- Shey na wey be rulers dey use una church-mind dey yarn? Una dey una use
clean hand dey judge men well? - No, for inside your mind you dey plan ojoro, and your hand dey make pipo fight
for di earth. - Wicked men don spoil from birth; na from belle dem don turn to jaguda and
dem dey tok lie. - Poison dey dia mouth like venom for snake mouth like cobra wey no dey hear,
- wey no gree hear di music of di jazz-man no mata as he try reach.
- Break di teeth wey dey dia mouth, Oh Baba-God; tear comot, cut di lion sharp
finger, Oh God. - Make dem vanish like water wey dey flow dey go; make dia arrow no sharp
wen dem draw di bow. - Like slug wey dey melt as hin dey move dey go, like pikin wey die for hin malee
belle, make dem no ever see sun. - Dem go sweep badbell pipo comot before your pot go start to dey feel di heat
of di sun, whether di pot green or dry. - Righteous pipo go dey happy wen Baba-God don revenge for dem, wen dem
use wicked man blood take wash their leg. - Men go con sey, “Baba-God still dey reward righteous pipo; surely God dey
wey dey judge di earth.”
Questions about Psalm 58
What is Psalm 58 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 58 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-58/
Where can I read Psalm 58 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 58 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-58/
Which Bible book contains Psalm 58?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 58?
The chapter identified by this reference is 58.