Psalm Chapter 59
- Free me from my enemies, Oh Baba-God; Protect me from those pipo wey wan
fight me. - Save me from pipo wey dey do bad-bad tins, and save me from men wey like
blood. - See as dem dey wait for me for corner! Rugged men gather toghther dey plan
bad for my back wey I no offend or sin against dem, Oh Lord. - I no do anytin wrong, but dem wan still fight me. Rise up make you epp me;
look my condition! - Oh Lord God Almighty, di Oga of Israel, soji yourself make you punish all di
Nations; make you no sorry for wicked traitors. - Dem don come back for evening dey halla like dogs, dem dey skemp upandan
di city. - See wetin dey comot for dia mouth—sword dey comot from dia lips, and dem
sey, “Who fit hear us?” - But you, Oh Baba-God, you laff dem, you laff di nations wit big laff.
- Chai my strength, I dey look you; you, Oh Baba-God, na you I dey hide my head
put. - My God wey I love. Baba-God go go for my front and go let me laff those pipo
wey dey tok bad for my back. - But no kill dem, Oh Baba-God awa shield or my pipo go forget. Wit your
power, make dem dey waka-waka upandan and make you fall dia hand. - Becos of di sins wey dem commit wit dia mouth, becos of di yarning from dia
lips, make God catch dem as dem dey make-mouth. Becos of di curses and lies
wey dem dey yarn, - burn dem wen you dey pkara, burn dem until dia arshes vanish. Naso everi-
pesin for di whole world go know sey na Baba-God dey rule Jacob. - Dem come back for evening dey halla like dogs, dey skemp di city upanda.
- Dem dey waka upanda for food, dey halla if dem no bellefull.
- But I go sing about your strength, for morning I go sing about your love; na
you be my strong-house, na your body I dey hide my head wen yawa gas. - Chai my strength, I go sing praises for you; you, Oh Baba-God, na you be my
strong-house, my loving God.
Questions about Psalm 59
What is Psalm 59 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 59 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-59/
Where can I read Psalm 59 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 59 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-59/
Which Bible book contains Psalm 59?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 59?
The chapter identified by this reference is 59.
Topics connected to this passage
- Love
- Hope
- Salvation
- Forgiveness
- Strength
- Worship