Psalm Chapter 60

Abeg share
  1. You don fashi us, Oh Baba-Go, you don burst for our head; e don tey wey you
    dey pkara—now make you give us beta again!
  2. You don shake di land, con tear am open; gum di pieces, e don scata.
  3. You don show your pipo rugged times; you give us shayo wey make us dey
    wagawugu.
  4. You don raise banner for pipo wey fear you—wey go dey cover dem against di
    bow.
  5. Save us and make you epp us wit your right hand, so dat those pipo wey you
    love go dey free.
  6. Baba-God don tok from inside hin holiness: ‘I go happy; I go devide Shechem con measure from bottom of di mountain of Succoth
  7. Na me get Gilead, na me get Manasseh. Ephraim na my helmet, Judah na my
    staff.
  8. Moab na basin wey I dey wash my hand put, I go throw my sandals for Edom,
    na for Philistia I go shout victory”
  9. Who go carry me go di city wey dey protected? Who go lead me go Edom?
  10. No be you, Oh Baba-God, you don fashi us and you no gree follow our army
    waka again?
  11. Give us epp to fight awa enemies, for man epp dey useless.
  12. Wit Baba-God we go win, and he go match our enemies for ground.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *