Psalm Chapter 68
- Make Baba-God stand up and make hin enemies scata; make hin enemies gbess
wen dem see am. - As breeze take dey blow smoke comot, make you blow comot; as wax take dey
melt wen faya touch am, naso badbelle pipo go pkeme for Baba-God front. - But make body sweet righteous pipo, and make dem jolly for Baba-God front;
make dem dey happy and make dem joyful - Sing for Baba-God, sing praises to hin name, cut-cap for am wey dey move wit
clouds—hin name na Baba-God and make you rejoice for hin front. - He be papa of pipo wey no get papa, na hin dey defend woman wey her
husband don die, na Baba-God for hin holy house.
6. - Wen you dey for you pipo front, Oh Baba-God, wen you match pass di waste
land, - di earth shake, heaven pour down rain fall, for Baba-God front, di God for Sinai,
for Baba-God front, di God of Israel. - You make rain fall brekete, Oh Baba-God; you ginger your inheritance wey don
taya. - Your pipo settle inside am, and you provide for poor pipo, from your yanfu-
yanfu, Oh Baba-God. - Great na di pipo wey preach di word wey Baba-God don yarn.
- “Kings and dia army gbess sharp-sharp; sote pipo go share di beta tins wey
dem bin carry follow body come. - Even wen you sleep around burn-faya, na silver nahin cover di wings, and
shinning gold cover hin feathers.” - Wen Baba-God almighty scata di kings wey dey di land, he be like wen snow
dey fall for Zalmon. - Di mountains of Bashan na majestic mountain; di mountain of Bashan rugged
finish. - Why you dey look wit jealousy, Oh rugged mountains of Bashan, for di
mountain where Baba-God don choose to reign, where Baba-God hinself go stay
forever? - Baba-God chariots pass ten thousand, and thousands of thousands; Baba-God
don come from Sanai enta inside hin holy-place. - Wen you ascend go up, you pack prioners follow body; men give you gifts,
even pipo wey don rebel give you gift—so dat you, Oh Baba-God, go fit stay there. - Praise be to Baba-God, to God wey save us, wey dey epp us carry our load
everiday. - Awa God na di God wey dey save pesin; Baba-God wey nobody dey control
nahin pesin fit escape pesin from death. - Baba-God go surely brake hin enemies head, he go shake di crowns of those
pipo wey dey follow dia way of sin. - God sey, “I go bring dem from Bashan; I go bring dem from di deep-deep sea,
- so dat you go waka ontop of di blood of your enemies, as di tongue of your
dog sef go collect hin own share.” - Pipo dey see your movement, Oh Baba-God, movement of my God and king
enta hin holy-place. - Di singers dey for front, afta dem na di musicians, wit the fine girl wey dey
shake di sheke-sheke. - Praise Baba-God for where hin pipo gather; praise Baba-God for where Israel
pipo gather put. - E get one small tribe wey dem dey call Benjamine wey dey lead dem, na there
Judah princes plenty put, and there di princes of Zebulun plus Naphtali dey. - Bring your power come down, Oh Baba-God, show us your strength, as you
don do before, Oh Baba-God. - Because of your temple wey dey Jerusalem, kings go bring gift come.
- Change am di wild animals wey dey among plants, change am for di plenty
malu wey dey among di calves of Nations. As e sempe, make e bring bars of silver.
Scata di natons wey like war. - King go end pipo come from Egypt; Cush go sapo herself to Baba-God.
- Sing for Baba-God, Oh kingdom of di earth, sing praise for God,
- To am wey dey move with the sky wey don old, wey dey shout like thunder.
- Make una tok about di power of Baba-God wey hin majesty dey ontop of
Israel. - You be elele for inside your holy-place; God of Israel dey give power and
strength to hin pipo. Praise be to Baba-God!
Questions about Psalm 68
What is Psalm 68 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 68 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-68/
Where can I read Psalm 68 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 68 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-68/
Which Bible book contains Psalm 68?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 68?
The chapter identified by this reference is 68.
Topics connected to this passage
- Salvation
- Forgiveness
- Strength
- Money
- Guidance
- Worship