Psalm Chapter 94

Abeg share
  1. Oh Baba-God, di God wey dey avenge. Chai Baba-God wey dey avenge, shine
    for us.
  2. Rise up, Oh judge of di earth; pay back dis pipo wey dey make-mouth—wetin
    dem deserve.
  3. Oh Baba-God, how long wicked pipo, how long wicked pipo go dey jubilate?
  4. Dem dey misyarn; all di evil doers sabi make-mouth well-well.
  5. Dem nack your pipo for ground, Oh Baba-God, dem oppress your inheritance.
  6. Dem kill woman wey her husband die and jjc; dem kill pipo wey no get palee.
  7. Dem sey, “Baba-God no dey see; di God of Jacob no dey hear pesin.”
  8. I dey warn una, wey no get sense for di community; mugu dem, wen una go get
    akonuche?
  9. Abi you think sey me wey give una ear no dey hear word? Abi me wey form
    eyes no dey see?
  10. Abi me wey dey correct nations no dey punish? Abi me wey dey teach man no
    know anytin?
  11. Baba-God know wetin man dey reason; he know sey dem dey useless.
  12. Blessed na di man wey you dey correct, Oh Baba-God, di man wey you dey
    teach from your law;
  13. you dey cool am down from days of wahala, until evil pipo enta grave.
  14. Baba-God no go bone hin pipo, he no go ever fashi hin inheritance.
  15. Judgement do dey inside rightrouesness again, and pipo wey get clean heart
    go follow am.
  16. Who go stand up epp me fight evil pipo? Who go hold ground for me, con
    change am for badbelle pipo?
  17. I for don shut-up for inside grave if to sey no be Baba-God wey con epp me.
  18. Wen I tok sey, “My leg dey dror-fall,” na your love, chai Baba-God, nahin
    support me.
  19. Wen my body dey shake wit fear, na you cool my soul wit joy.
  20. Abi corrupt throne fit be your padi—throne wey dey bring suffer-head wit dia
    law?
  21. Dem gather together wan change am for righteous pipo, con comdemn
    innocent pipo to death.
  22. But na Baba-God be my strong-house.
  23. He go repay dem for dia sins, con scata dem becos of dia wickedness; Baba-
    God wey be awa Oga go dabaru dem.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *