Psalm Chapter 95

Abeg share
  1. Sing new song for Baba-God; sing for God, all di whole earth.
  2. Sing for Baba-God, praise hin name; tok about hin salvation day by day.
  3. Tok about hin glory for front of di nations, con yarn about hin ogbonge works
    among all hin pipo.
  4. Baba-God na ogbonge and he get levels to receive awa praise; dem suppose
    fear am pass all di oda gods.
  5. All di gods of di nations na idols, but na Baba-God make di heavens.
  6. Beauty and majesty dey for hin hand. Strength and glory dey hin holy-place.
  7. Make all the families of di nations tok sey na Baba-God get glory and strength.
  8. Give Baba-God di glory wey fit hin name; bring offering come hin caban.
  9. Worship Baba-God inside di beauty of hin holiness; make all di earth shake for
    hin front.
  10. Tok among of di nations sey, “Baba-God dey on board.” Di world stand
    gidigbam, e no fit move; he go judge di pipo wit hin church-mind.
  11. Make di heavens rejoice, and make di earth jolly; make di seas make noise
    plus everitin wey dey iniside am;
  12. make di field jubilate and everitin wey dey inside. Naso all di trees wey dey
    inside di forest go sing wit joy;
  13. dem go sing for Baba-God front, becos he dey come, he dey come judge di
    earth.
  14. He go judge di world wit clean-heart and judge di pipo wit truth.

Questions about Psalm 95

What is Psalm 95 in Pidgin Bible?

This page contains Psalm 95 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-95/

Where can I read Psalm 95 in Nigerian Pidgin?

You can read Psalm 95 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-95/

Which Bible book contains Psalm 95?

Psalm is the Bible book identified by this reference.

What chapter is Psalm 95?

The chapter identified by this reference is 95.

Topics connected to this passage

  • Salvation
  • Strength
  • Worship

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now