Psalm Chapter 149
Dis Na Hymn Of Praise
1. Praise Baba-God, sing new song for Baba-God, and sing about hin praise for where hin holy-pipo gada put.
2. Make Israel happy for di God wey make am; make di pipo of Zion dey happy for dia King.
3. Make dem praise hin name wit dancing, and make dem praise am wit sheke-sheke, plus harp.
4. Baba-God belle dey sweet am for hin pipo, he go use salvation take make low-key pipo fine.
5. Make di holy-pipo happy wit levels, con sing out on top of dia beds.
6. Make Baba-God high praise dey for dia mouth, and make sword wey get two side dey for dia hand,
7. to pay back di nations, and to punish di pipo,
8. to tie dia kings wit chains, and tie dia leaders wit iron chain,
9. to carry out di judgement wey dem don write for dem. Dis honour dey for all hin holy-pipo. Make una praise Baba-God.