Proverbs Chapter 26
Levels No Fit Mumu
- Like snow for hot season, or rain for
harvest, naso respect no-fit mugu. - Like birds wey dey fly komot, naso curse
wey no be for pesin—no go fit fall on am. - Flogging na for horse, rope na for donkey,
and koboko for mumu back! - No ansa mumu based- on hin level, or
yousef go be mumu like am. - Ansa mumu in a mumu way, or he go tink
sey he wise. - To send dondi message be like sey, make
pesin cut hin leg komot, and drink fight-fight. - Proverb for swegbe mouth, be like useless
leg wey paralyze. - To give mugu respect—be like make pesin
tie stone for catapult. - Like shuku-shuku for drunkard hand, naso
proverb be for mumu mouth. - Di ogbonge God wey make everitin dey
give mumu pipo dia pay, and he dey pay evil
pipo dia salary. - As dog take dey go back to chop e vomit,
naso mumu pipo take dey repeat dia yeye
way. - Abi you neva see man wey tink sey he
wise for hin own eyes? Swegbe get hope
pass am. - Lazy man go tok sey, “Lion dey for road,
lion wey dey para dey patrol for street!” - As door take dey open wit e hinges, naso
lazy man take dey go sleep for bed. - Lazy man go put hin hand for plate, but
hin hand dey heavy am to carry put for hin
mouth. - For lazy man eyes, he wise pass seven
men wey dey reason well. - Pesin wey dey waka pass, wey con
shuuk-mouth for mata wey no concern am,
be like mumu pesin wey go drag dog for e
ear. - Like craseman wey dey shoot arrow of
faya, sharp arrow, plus death, - naso pesin wey dey scam hin neighbour
be—he go con tok sey, “Na play I dey follow
you play!” - Faya go quench if faya- wood no dey;
quarrel go end if aproko no dey. - As charcoal be to coal wey dey burn, and
as wood be to faya, naso man wey like
kwanta dey put faya for quarrel. - Aproko words be like small sweet food
wey dey enta body. - Like polish wey dey cover clay pot, naso
sweet-mouth wey dey hide bad-mind be. - Evil pesin dey pretend wit hin
words—but na mago-mago full hin heart. - Even though he tok wit kindness, no
believe dem. Na seven tufiakwa dey for hin
heart. - Even though he cover hin badbelle wit
wayo, but hin wickedness go cast for where
pipo gada. - Man wey dig pit—go fall inside di pit,
and pesin wey roll stone, di stone go roll
back on am. - Pesin wey dey tok lie, hate di pesin wey
he dey lie on top hin head, and mouth wey
dey hail pesin dey spoil tins.
Questions about Proverbs 26
What is Proverbs 26 in Pidgin Bible?
This page contains Proverbs 26 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/proverbs-chapter-26/
Where can I read Proverbs 26 in Nigerian Pidgin?
You can read Proverbs 26 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/proverbs-chapter-26/
Which Bible book contains Proverbs 26?
Proverbs is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Proverbs 26?
The chapter identified by this reference is 26.
Topics connected to this passage
- Wisdom
- Guidance