Proverbs Chapter 31
Di Words of King Lemuel
- Dis na di words of king Lemuel—oracle
wey hin mama teach am. - “Chai my son, chai my pikin wey I carry
for my belle, chai my pikin of promise, - no give your pawa to women, no follow
those pipo wey dey spoil kings. - “No be for kings, Oh Lemuel—no be oba
suppose dey drink wine, no be rulers
suppose dey drink ogogoro. - Or dem go high—com fashi di law, and
bend di justice of pipo wey dey suffer. - Give ogogoro to pipo wey dey kpeme, and
give wine to pipo wey dey feel pain. - Make he drink, con forget hin poverty, and
fashi dat tin wey dey worry hin mind. - “Tok for those pipo wey no get mouth to
tok, tok about di rights of those pipo wey dey
face death. - Open your mouth to give good judgement,
fight for poor pipo, plus pipo wey need epp.”
Woman Wey Get Beta Character - Who fit fyne wife wey get beta
character? She get value pass rubies. - Her husband believe her well-well, and
she dey give am everi beta tin wey he want. - All di days of her life, she dey show am
good tins, no be tins wey go wound am. - She dey select wool and flax, and she dey
enjoy her handwork. - She be like ship for water—wey dey
bring market from far-far. - She dey wake up for night to arrange
food for her family, and her house-girls. - She see land wey she like, she pay for
am—from her moni wey she don make—she start her grape-farm. - She strong kakaraka, and she dey hustle
well-well wit her hand. - She know sey her business dey move,
and her lamp no dey off for night. - She dey use her hand make her cloth, and
she dey weave her own cloth. - She sabi give poor pipo tins, and she dey
give pipo wey need epp. - Wen cold dey, she no dey fear for her
family, becos all of dem get sweater. - She dey make her own bed sheet; she dey
wear fine linen cloth and purple gown. - Dem dey respect her husband for di gate
of di city, wen he dey sidon wit di senior-men
of di land. - She dey make linen dress wey she dey
sell, and she dey supply girdle for market-
pipo. - She wear pawa and respect for body, and
she go happy for future. - She dey tok wit wisdom, and beta words
nahin dey for her mouth. - She dey take care of all her family mata,
and she no dey chop di bread of laziness. - Her pikin go stand up con tok sey she be
blessing, and her husband sef go cut-cap for
her: - “Plenty women dey do well, but your
level pass all of dem.” - Fine-f ine-t ins f i t deceive pesin, and
beauty dey fade, but make dem cut-cap for
woman wey dey fear Baba-God.
Give her di pay wey she suppose get, and her
hustle go make pipo cut-cap for her for
publik.