Isaiah Chapter 12
Di Song of Tanks-giving
- On dat day, una go tok sey, “Oh Baba-God, I go praise you, even though you bin dey vex for me, your vex don turn komot and you don cool me down.
- See, Baba-God don save me. I go trust and I no go let fear catch me, becos Oga Chineke na my pawa and my song. Evensef, he don turn to di pesin wey dey save me.”
- So na wit happiness you go take fetch water from di wells wey dey save una.
- On dat day, you go tok sey, “Praise Baba-God, call hin name, tell pipo wetin he dey do, tok sey hin name get levels.
- Sing to Baba-God, becos he don do beta tins, make pipo know dis tins round di whole world.
- Make di pipo of Jerusalem shout hin praise wit happiness! Becos di Holy One of Israel wey dey live among una na ogbonge.
Questions about Isaiah 12
What is Isaiah 12 in Pidgin Bible?
This page contains Isaiah 12 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/isaiah-chapter-12/
Where can I read Isaiah 12 in Nigerian Pidgin?
You can read Isaiah 12 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/isaiah-chapter-12/
Which Bible book contains Isaiah 12?
Isaiah is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Isaiah 12?
The chapter identified by this reference is 12.
Topics connected to this passage
- Faith
- Salvation
- Fear
- Worship