Genesis Chapter 35
Jacob Go Back To Bethel
- Baba-God tell Jacob sey, “Stand up make you dey go Bethel, con stay for there, and make altar for Baba-God for there—for Baba-God wey show-face to you wen you dey run from Esau your broda.
- Jacob con tell hin family plus all di pipo wey dey wit am sey, “Komot di foreign gods wey dey around una, and make una dey clean, con change una cloth.
- And make we stand up, con dey go Bethel. I go make altar for Baba-God for there—for Baba-God wey ansa me for di days wen my heart dey cut, and wey dey wit me for di way wey I follow.”
- So dem give Jacob all di foreign gods wey dey for dia hand, plus all dia earrings wey dey for dia ears. Naso Jacob hide dem under di oak tree wey dey near Shechem.
- So dem travel dey go, serious fear from Baba-God con dey on di cities wey dey round dem—sote dem no get-liver to pursue di sons of Jacob.
- Naso Jacob reach Luz wey dey inside di land of Canaan—wey be Bethel, him plus all di pipo wey dey wit am.
- He build altar for there and he call am, ‘El-beth-el’; wey mean, ‘God of Bethel’—becos Baba-God show-face to am for there—wen he dey run from hin broda Esau.
- But Deborah wey bin dey serve Rebekah con kpeme, and dem bury her for di south side of Bethel— under di oak tree. Di name of di place na Allon-bachuth.
- So Baba-God show-face to Jacob again wen he komot from Padan-aram, con bless am.
- Baba-God tell am sey, “Your name na Jacob, but your name no go be Jacob again, but Israel nahin go be your name.” And he call hin name Israel.
- Naso Baba-God tell am sey, “Na me be Baba-God Almighty, make una go get plenty pikin, con brekete; nations plus plenty-plenty go come from you, even kings go come from inside you.
- Di land wey I give Abraham plus Isaac—nahin I go give you as your own. And di pikin wey dey afta you sef nahin I go give di land.
- Naso Baba-God komot from di place where he follow Jacob tok.
- So Jacob set up big stone for there, so dat he go remember di place wey Baba-God follow am tok, he con pour drink offering on top am, and he pour ororo put sef.
- Naso Jacob call di name of di place wey Baba-God follow am tok—Bethel.
Rachel Kpeme
16. Dem travel komot from Bethel—con dey near Ephrath, time con reach for Rachel to born pikin— and she feel pain well-well as she wan born.
17. E con happun sey as she dey for hard labor—di nurse tell her sey, “No let fear catch you, you go born dis baby-boy sef.”
18. She con dey breath her last breath becos she dey die—she name di boy Ben-oni, but hin papa call am Benjamin. So she kpeme.
19. Naso Rachel kpeme, and dem bury her around Ephrath wey dey for Bethlehem.
20. Jacob build block of stone for her grave—wey dey for there till today.
21. So Israel travel, con spread hin tent afta di tall-house of Edar.
Jacob Sons
22. E happun sey as Israel dey for di land, Reuben con go sleep wit Bilhah—hin papa side-chick and Israel con hear am. Now di sons of Jacob na twelve.
23. Dis na di sons of Leah: Reuben—wey be Jacob first born, Simeon, Levi, Judah, Issachar, plus Zebulun.
24. Dis na Rachel sons: Joseph plus Benjamin:
25. Dis na di sons of Bilhah wey be Rachel house-girl: Dan plus Naphtali.
26. And dis na di sons of Zilpah wey be Leah house-girl; Gad plus Asher. Na dis be di sons of Jacob wey dem born for am for Pada-aram.
Isaac Kpeme
27. And Jacob come meet Isaac hin papa for Mamre, for di city of Arbah wey dey for Hebron—where Abraham and Isaac travel.
28. Isaac live for hundred and eighty years.
29. So Isaac die wen he don old well-well, naso he join hin ancestors, and hin son Esau plus Jacob bury am.