Genesis Chapter 36
Esau Family
- Na di generations of Esau be dis—wey be Edom.
- Esau marry from di daughters of Canaan; Adah wey be di daughter of Elon di Hittite, plus Aholibamah wey be di daughter of Anah—grand-daughter of Zibeon di Hivite;
- And Bashemath wey be Ishmael daughter—wey be di sista of Nebajoth.
- Adah born for Esau. Hin name na Eliphaz. Bashemath con born Reuel;
- Aholibamah born Jeush, Jaalam, plus Korah; na dis be di sons of Esau wey dem born for am for di land of Canaan.
- Esau carry hin wives, plus all hin sons and daughters, plus everi pesin wey dey for hin house, and hin malu, plus all hin animals, and all di properties wey he don get from di land of Canaan; con komot go anoda kontri—from hin broda Jacob;
- Becos dem rich well-well sote dem no fit dey togeda, and dem no fit stay for di land wey dem dey live as (jjc) foreigners, becos dia animals too plenty.
- So Esau stay for di mountain of Seir; Esau nahin be Edom.
- Na dis be di generation of Esau—di ancestor of di Edom for di mountain of Seir.
- Na dis be di name of Esau sons; Eliphaz—wey be di son of Adah—wey be Esau wife, Reuel wey be di son of Bashemath—wey be Esau wife.
- Di sons of Eliphaz na; Teman, Omar, Zepho, and Gatam, plus Kenaz.
- Timna na di side-chick of Eliphaz wey be Esau son. And she born Amalek for Eliphaz; na dis be di sons of Adah wey be Esau wife.
- Na dis be di sons of Reuel; Nahath, Zerah, Shammah, plus Mizah; na dis be di sons of Bashemath—wey be Esau wife.
- Dis be di sons of Aholibamath, wey be di daughter of Anah—wey be di grand-daughter of Zibeon, Esau wife: and she born Jeush for Esau, and Jaalam, plus Korah.
Di Chiefs Of Edom
15. Na dis be di tribes wey komot from Esau. Esau first son wey be Eliphaz nahin be di ancestors of dis tribe chiefs: Teman, Omar, Zepho, Kenaz,
16. Korah, Gatam, plus Amalek. Na dis be all di chiefs wey come from Elipphaz for di land of Edom, dem be di sons of Esau wife Adah.
17. Esau pikin wey dem dey call Reuel nahin be di ancestor of dis tribes wey be from Edom: Nahath, Zera, Shammah, plus Mizzah. Na dis be all di sons of Esau wife Basemath.
18. Na dis be di sons of Aholibamah wey be Esau wife and wey be di daughter of Anah; Jeush, Jalam plus Korah. Na dis ones be di chiefs wey Aholibamah born—wey be Anah daughter and Esau wife.
19. All dis tribes na di pikin-pikin-pikin of Esau.
Di Sons of Seir
20. Na dis be di names of di tribes wey be di pikin-pikin-pikin of Seir wey be Horite. Dem live for di land of Edom: Lotan, Shobal, Zibeon, Anah,
21. Dishon, Ezer plus Dishan. Na dis be di leaders of di families of di Horites wey be di sons of Seir—wey live for di land of Edom.
22. Di sons of Lotan na Hori plus Hemam. Lotan sista name na Timna.
23. Di sons of Shobal na Alvan, Manahath, Ebal, Shepho, plus Onam.
24. Di sons of Zibeon na Aiah plus Anah. (Na dis be di Anah wey see one place wey water dey komot from ground—for inside desert, as he dey take care of hin papa donkeys.)
25. Na dis be di pikins of Abah: Dishon, and Oholibamah wey be Abah daughter.
26. Di sons of Dishon na; Hemdan, Eshban, Ithran, plus Keran.
27. Di sons of Ezer na; Bilhan, Zaavan, plus Akan.
28. Di sons of Dishan na; Uz plus Aran.
29. Na di leaders of di Horites families be dis: Lotan, Shobal, Zibeon, Anah,
30. Dishon, Ezer, plus Dishan. Den name di Horites families afta dia leaders wey live for di land of Seir.
Di Kings Of Edom
31. And na dis be di kings wey reign for di land of Edom before kings even start to reign for Israel.
32. Bela wey be di son of Beor reign for Edom; and di name of hin city na Dinhabah.
33. So Bela die and Jobab wey be di son of Zerah of Bozrah con be king.
34. Jobab kpeme, and Husham wey be from di land of Temani, con be king.
35. Wen Husham die, Hadad wey be di son of Bedad wey attack Midian for di kontri of Moab—con take him position as king: and di name of hin city na Avith.
36. So Hadad con die, and Samlah of Masrekah con be di new king.
37. Samlah sef kpeme, so Saul of Rehoboth wey dey near di river con be di king.
38. Naso Saul kpeme, and Baal-hana wey be di son of Achbor con be king.
39. So Baal-hana wey be di son of Achbor die, and Hadar con be king. Di name of hin city na Pau; and hin wife name na Mehetabel wey be di daughter of Matred—wey be di grand-daughter of Mezahab.
Di Chiefs of Esau
40. Na dis be di names of di leaders of di families wey be di sons of Esau, wey live for di places wey dem give dia own name: Timna, Alvah, Jetheth,
41. Oholibamah, Elah, Pinon,
42. Kenaz, Teman, Mibzar,
43. Magdiel, plus Iram. Na dis be di chiefs of di families of Edom wey dem name based-on dia area for di land wey dem dey stay. Na Esau be di papa of di Edomite.