Jeremiah Chapter 28

Abeg share

Hananiah Wey Prophecy

  1. For di fifth month of dat same year, di fourth year, wen Zedekiah wey be king of Judah first climb di king-chair, di prophet Hananiah, son of Azzur, wey be from Gibeon—con tell me sometin for inside Baba-God house, for front of di priests and all di pipo.
  2. “Dis na wetin Baba-God Almighty tok—di God of Israel: ‘I don break di wood wey di king of Babylon put for una neck—like malu wey dey drag load.
  3. From now to two years time, I go bring back di beta-beta-tins for Baba-God house wey king Nebuchadnezzar bin carry komot go Babylon.
  4. I go carry Jeconiah come back to dis place— Jehoiachin wey be di son of Jehoiakim, di king of Judah, wit all di oda pipo wey dem carry komot from Judah go Babylon. I go break di wood wey di king of Babylon put for una neck—like malu wey dey drag load,’ naso Baba-God tok. ”
  5. So prophet Jeremiah ansa prophet Hananiah for front of di priests, plus all di pipo wey dey for Baba-God house.
  6. He tok sey, “Iseeee! Make Baba-God do am. Make Baba-God do di words wey you don prophesy by bringing di tins wey dem carry komot from Baba-God house, and all di pipo wey dem carry komot as prisoners—back to dis place.
  7. But listen to wetin I wan tell you and all di pipo:
  8. From di starting, di prophets wey bin dey before you and me, don prophesy about; war, kasala, plus disease, against both plenty kontris and ogbonge kingdoms.
  9. But di propehts wey prophesy about peace—dem go tok sey na prophet wey Baba-God send, only if wetin he prophesy happun.”
  10. Naso Hananiah di prophet komot di heavy wood wey dem dey put for malu neck to drag load—from Jeremiah neck, con brake am to pieces.
  11. And he tok for front of all di pipo again, sey, “Dis na wetin Baba-God tok: ‘Just as dis wood wey dem dey put for malu neck to drag load—don break, from now till two years, I go break di heavy wood wey dem dey put for malu neck—from di neck of all di nations wey dey under di king Nebuchadnezzar of Babylon now.’ ” Naso Jeremiah komot from Baba-God house.
  12. Just afta prophet Hananiah break di wood wey dem dey put for malu neck to drag load—from Jeremiah neck, Baba-God con give dis message to Jeremiah:
  13. “Go tell Hananiah sey, ‘Dis na wetin Baba-God tok: you don break di wood wey dem dey put for malu neck to drag load—but you turn di wood to iron for dia neck.”
  14. Dis na wetin Baba-God Almighty tok, di God of Israel, “I don put heavy iron for di back of all dis nations—like di wood wey dem dey put for malu back to drag load—so dat dem go serve king Nebuchadnezzar of Babylon, and dem go serve am. I don give am even di animals sef.”’”
  15. Naso prophet Jeremiah con tell Hananiah di prophet sey, “Listen, Hananiah! Baba-God no send you any message, but you don use style make dis nation trust your lies.
  16. So na wetin Baba-God tok be dis: ‘See, I go soon komot you from di face of dis earth. Na dis year you go kpeme, becos you don preach sey make pipo no obey Baba-God.’ ”

Questions about Jeremiah 28

What is Jeremiah 28 in Pidgin Bible?

This page contains Jeremiah 28 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/jeremiah-chapter-28/

Where can I read Jeremiah 28 in Nigerian Pidgin?

You can read Jeremiah 28 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/jeremiah-chapter-28/

Which Bible book contains Jeremiah 28?

Jeremiah is the Bible book identified by this reference.

What chapter is Jeremiah 28?

The chapter identified by this reference is 28.

Topics connected to this passage

  • Faith
  • Peace
  • Obedience

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now