Ezekiel Chapter 27
Cry For Tyre
- Baba-God word come meet me again, sey:
- “Man pikin, sing burial song for Tyre,
- Tyre wey be di gate to di big-water [sea], wey be di biggest market for di world. Give Tyre dis message from Baba-God Almighty: “Chai, Tyre, you bin dey make-mouth sey, ‘See as I fine well-well!’
- Your borders enta di middle of di big-river. Di pipo wey build you make you fine—no be small [dem make your beauty perfect].
- You bin dey like big ship wey dem build wit di fire wood from Senir. Dem carry Cedar from Lebanon to make pole for you.
- Dem carve your paddle from di oaks trees of Bashan. And di Ashurites cover your planks wit ivory from di water-side of Cyprus.
- Dem make your ship-cloth wit di best linen wey dem design from Egypt [so dat e go be your sign]; blue and purple cloth from di island of Elishah nahin be your canopy wey cover you [canopy of dia ship].
- “Men of Sidon plus Arvad nahin dey paddle your ship; oh Tyre, your wise men wey dey inside you nahin be your sailors [pipo wey dey drive ship].
- Old wise men from Gebal nahin dey patch di places wey dey leak, ships from everi land come wit dia market to exchange market wit una.
- “Di men of Persia, Lydia plus Put serve as sojas for your army. Dem hang dia shield plus helmets for your walls, and dem make you fine.
- Men of Arvad wit your army bin dey guard your wall for everi side; and di men of Gammad dey for una tall-houses. Dem hang dia shields around your walls; dem con make you fine well-well.
- “Tarshish do business wit you, becos of your ogbonge beta-beta market; dem exchange silver, iron, tin plus lead—for una market.
- Javan, Tubal plus Meshech do business wit una; dem exchange slaves plus different kain tins wey dem make wit bronze—for una market.
- “Men of Togarmah exchange horses, horses for war, and mules—wit una market.
- Di men of Dedan do business wit una, and many island na una customers; dem pay una wit ivory horns plus ebony.
- Syria do business wit una becos of una plenty market wey una dey produce; dem exchange emarald, purple cloth, designer cloth, fine linen, and jewelries of coral plus rubies.
- Judah plus Israel do business wit una; dem exchange wheat from Minnith, figs, honey, ororo, plus cream.
- Damascus do business wit una, wit wine from Helbon plus wool from Zahar—becos of your plenty beta-beta market.
- “Dan plus Javan do business wit una market from Uzal, dem exchange una market wit; wrought iron, cassia and calamus.
- Dedan na your customer for fine cloth wey dem dey use take sidon for horse back.
- Arabia plus all di princes of Kedar na your customers wey dey always do business wit una—wit lambs, rams plus goats.
- Di market-pipo of Sheba plus Raamah do business wit una, dem exchange all di fine kind of spices for una market, plus fine-fine-stones, and gold.
- Haran, Canneh plus Eden, and di market-pipo Sheba of Asshur and Chilmad—do business wit una.
- For una market, dem do business wit una; dem bring fine-fine wrapper to sell; blue clothes, cloth wey dem design, plus cedar box of fine cloth [wit different-different colours] wey dem tie wit fine-fine chains.
- “Di ships of Tarshish nahin dey carry una market. Una full wit plenty market, con get levels well-well for di big- rivers.
- Di men wey dey drive una ship carry una go big-big-rivers, but di strong-breeze from east break una to pieces for middle of di big-rivers.
- Your beta-beta-tins, plus your market, your properties, your sailors and di pipo wey dey cover di places wey dey leak, your market-pipo, all una sojas wey dey wit una, wit all una pipo—go fall for inside di big-river on di day wen you go scata.
- Una cities wey dey near water go dey shake as una sailors dey cry.
- And all di men wey dey move di ship go run komot from di ship; both di sailors plus all di captains of di water go stand for land,
- Dem go raise dia voice, con cry well-well for una; dem go sprinkle dust for dia heads, con roll for ashes.
- Dem go shave dia heads gorimakpa becos of una, and dem go wear sackcloth. Dem go cry for una wit pain for inside dia soul and wit bad cry.
- As dem dey cry and shout becos of una, dem dey sing dis sad song for una: ‘Abi any city bin dey like Tyre before, city wey don scata for middle of big-river?
- Wen una market dey for big-river, una satisfy plenty nations wit una plenty beta-beta-tins plus una market, and una make di kings of di earth rich.
- Now wey di big-river go scata una inside di deep-deep water; una market plus all di pipo wey dey wit una go go down wit una.
- All di pipo wey dey stay for di island go shock; all dia kings go fear well-well, and worry-worry go dey for dia face.
- Di market pipo among dem go hiss for una; una don end wit gbege, and una no go dey again forever.’”’”