Nahum Chapter 2
As Nineveh Take Fall
- Pipo wey go scata una to pieces dey move come meet una. Guard di strong-house, watch di roads, defend yoursef, gada all your pawa!
- Even though di enemy don scata Jacob, Baba-God go bring back di levels of Jacob. Dem don cut di fruit of Israel from e branches, but e go grow con shine again.
- Di shield of dia sojas dey red, di strong sojas dey wear red uniform! See as dia shinning horse-moto dey move go dia position, and dem dey show dia long-sharp-weapon.
- Di horse-moto dey run anyhow for di streets, dem dey run follow demsef for di wide road. Dem dey flash like light from faya, and dem dey move fast-fast like lightning.
- Di king dey shout for hin officers; dem fall as dem dey rush—as dem dey rush go di wall to defend di wall.
- Dem don burst di river gates open! Di palace go soon fall.
- Dem bin tok am sey: Dem go catch her as slave go foreign land; and her servant girls go dey cry like doves—dey beat dia breasts wit sadness.
- Before-before, Nineveh be like pool, but now e water dey dry dey go. Pipo dey shout, “Stop! Stop!” but no pesin turn back.
- Steal di silver! Move di gold! Dem plenty well-well, dia beta-beta-tins brekete!
- Nineveh don empty, pipo don run komot, and e don scata! Hearts dey melt, and knees dey shake; pain burku for inside everi pesin body, and all dia faces dey fade.
- Where di lion joint con dey, where di place where di young lions dey chop, where di lion dey waka put, di lioness and her small-small pikin—wit notin to make dem fear?
- Di lion kill yanfu-yanfu for e pikin, e kill for e wife; di lion hide e meat for inside rock, con pack flesh full e joint.
- Baba-God Almighty tok sey, “I dey against you, I go burn your horse-moto inside smoke, and sword go shuuk your young lions, I go stop you from oppressing pipo. Dem no go hear di voice of your messengers again.”