Matthew Chapter 16

Abeg share

Dem Ask For Sign

  1. Di Pharisees plus Saducees come meet Jesus, con test am sey—make he show dem sign from heaven.
  2. He ansa dem sey, “Wen evening reach una go tok sey, ‘Di weather go good, di sky dey red,’
  3. and for morning una go tok sey, ‘Strong-breeze go dey today, di sky dey red and dull.’ Una sabi read di weather, but una no fit interpret di signs of di time.
  4. Wicked and ashawo generation dey fyne miracle sign, but dem no go see shi-shi except di sign of Jonah.” Jesus con leave dem waka go.

Di Pharisees And Saducees Yeast

5. As dem komot go di oda side of di water, di disciples forget to carry bread.

6. Jesus con tell dem sey, “Make una dey careful, shine your eyes for di Pharisees and Saducees yeast.”

7. Dem con dey follow demsef tok di mata sey, “Na becos we no carry any bread.”

8. Jesus know wetin dem dey tok, so he tok sey, “Una wey get small faith, why una dey follow unasef dey tok sey bread no dey?

9. Abi una neva still understand? Una don forget di five bread and di five thousand pipo, and how many basket una gada?

10. Or di seven bread and di four thousand pipo, and how many full basket una gada?

11. How una no understand sey I no dey tok about bread? But make una shine una eyes for di Pharisees and Saducees yeast.”

12. So di disciples con understand sey he no dey tell dem to shine dia eyes for di yeast wey dem dey use make bread, but against wetin di Pharisees and Saducees dey teach.

Peter Confam Christ

13. Wen Jesus reach Caesarea Philippi area, he ask hin disciples, “Who pipo tok sey Man- pikin be?”

14. Dem ansa am, “Some pipo tok sey you be John di Baptist; odas tok sey na Elijah you be; and some odas tok sey, na Jeremiah, or one of di prophets.”

15. Jesus con tok sey, “Wot about una, who una tink sey I be?”

16. Naso Simon Peter ansa am sey, “Na you be di Christ di son of di living God.”

17. Jesus ansa, “Blessings for Simon, son of Jonah, no be man tell you dis tin, but na my papa wey dey for heaven.

18. And I dey tell you sey, na you be Peter [wey mean ‘rock’], and on dis rock nahin I go build my church, and di gates of hell no fit win am.

19. I go give you di keys of di kingdom of heaven; anytin wey you bind for earth go bind for heaven, and anytin wey you loose for earth go loose for heaven.”

20. He warn hin disciples sey make dem no tell any-pesin sey nahin be di Christ.

Jesus Predict Hin Death

21. From dat time go, Jesus con start to dey explain to hin disciples sey—he must go Jerusalem and di senior-men, di chief priests plus teachers of di law go suffer am, and sey dem must kill am, but he go raise up to life for di third day.

22. Peter carry am go one corner con dey change-am-for am sey, “Lai-lai, Oga! Dis kain tin no go ever ever happun to you!”

23. Jesus turn, con tell Peter sey, “Oya komot go my back Satan! You be l ike stone for my way to make me fall; you no get di tins of Baba-God for your mind, but di tins of men nahin dey for your mind.”

24. Naso Jesus tell hin disciples sey, “If any-pesin wan follow me, he must forget hinsef con carry hin cross—dey follow me.

25. Any-pesin wey wan save hin life go lose am, and any- pesin wey lose hin life becos of me go gain am.

26. Wetin you gain if you get di whole world con lose your soul? Or wetin man fit give take exchange for hin soul?

27. Man-pikin go show wit hin Papa levels and wit hin angels, he go pay everi-pesin based-on how dem take run tins.

28. I dey tell una di truth, some pipo wey dey stand for here no go kpeme before dem go see Man-pikin dey come inside hin kingdom.”

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *