Mark Chapter 15

Abeg share

Jesus For Pilate Front

  1. For early mor-mor, di chief priests, plus di senior-men, di teachers of di law and di whole Council con gree. Dem tie Jesus, con carry am go meet Pilate.
  2. Pilate con ask am “Shebi na you be di King of di Jews?” Naso Jesus tell am sey, “Yes, as you tok am, na so e be.”
  3. Di chief priests tok sey he do plenty bad tins.
  4. Pilate con ask am again, “You no go ansa? See how many bad tins dem dey tok sey you do.”
  5. Jesus no still tok anytin. Pilate con surprise.
  6. Na dia tradition for di Festival sey dem go free one prisoner wey di pipo ask for.
  7. One man wey dem dey call Barabbas bin dey for prison, wit hin fellow rebels—wey kill pesin wen dem try to take over govment.
  8. Plenty pipo con go meet Pilate make he do wetin he dey always do for dem.
  9. Pilate con ask dem sey, “Shebi una wan make I free di king of di Jews?”
  10. He know sey na becos di chief priests dey jealous Jesus, nahin make dem carry Jesus come meet am.
  11. But di chief priests ginger di plenty pipo sey, make dem tell Pilate to free Barabbas for dem, instead of Jesus.
  12. Pilate con ask dem “Wetin una wan make I do wit di one wey una dey call King of di Jews?”
  13. Dem con halla, “Nail am for cross!”
  14. Pilate con ask dem sey, “Why? Which crime he commit?” But dem con dey halla more-more, “Nail am for cross!”
  15. As Pilate wan make di pipo happy, he release Barabbas for dem. He sey make dem flog Jesus, and make dem hang am for cross.

Di Sojas Dey Yab Jesus

16. Di sojas carry Jesus go di palace (wey be di headquarters of di govnor), con call all di sojas.

17. Dem wear am one purple cloth, dem use shuku-shuku make crown for am, con put am for hin head.

18. Dem con dey hail am, “Tuale, King of di Jews!”

19. Dem use stick nack hin head plenty times, con dey spit for hin body. Naso dem dey kneel down dey pretend to worship am.

20. Wen dem don yab am finish, dem komot di purple cloth wey dem wear for hin body, con wear am back hin own cloth. Naso dem carry am go where dem go hang am for cross.

As Dem Take Hang Jesus For Cross

21. One man wey dem dey call Simon from Cyrene—wey be Alexander plus Rufus papa, dey come from di kontri-side dat time. Naso dem use gra-gra make am carry di cross.

22. Dem carry Jesus reach di place wey dem dey call Golgotha (wey mean, place of skull).

23. Dem con give am wine wey dem mix wit myrrh, but he no gree drink am.

24. Dem nail am for cross, dem divide hin cloth, con roll dice to share di pieces of hin clothes.

25. Na nine o’clock for morning dem nail am for cross.

26. Dem write sign board about di mata wey dem put for hin head: DI KING OF DI JEWS.

27. Dem hang two tiff for cross wit am, one for hin right and one for hin left.

28. Dis one confam wetin di Holy-books tok sey, “Dem count am join jaguda pipo.”

29. Pipo wey dey waka pass dey curse am, dem dey shake dia head—con dey tok sey, “Haba, you wey wan scata di worship-place con build am for three days,

30. come down from di cross make you save yoursef!”

31. Naso di chief priests plus di teachers of di law dey laff am sef. Dem tok sey, “He save oda pipo but he no fit save hinsef!

32. Make dis Christ, dis king of Israel, come down now from di cross, so dat we go see, and believe.” Even di pipo wey dem nail for cross wit am sef—dey curse am.

As Jesus Take Die

33. For twelve o’clock, everi-where con dark reach three o’clock.

34. Around three o’clock, Jesus cry wit loud voice, “Ubangiji [Baba-God], Ubangiji [Baba-God], kini idi ti o fi ko me sile?”—wey mean, “Oluwa, Chineke, why you con fashi me?”

35. Wen some pipo wey stand for there hear wetin he yarn, dem con tok sey, “See, he dey call Elijah.”

36. One man run go carry sponge, con full am wit sawa wine, he put am for stick, con carry am give Jesus make he drink. He tok sey, “Now make una leave am, make we see if Elijah go con carry am come down!”

37. Wit loud cry, Jesus con breath hin last breath.

38. Di curtain wey dey for inside di worship-place con tear into two from up to down.

39. Wen di soja wey dey for Jesus front hear hin cry, con see how he take die, he tok sey, “True- true dis man na Baba-God pikin!”

40. Some women dey watch from far-far. Among dem na, Mary Magdalene, Mary (di younger James mama and Joseph), and Salome.

41. Dem be Jesus followers wen he dey for Galilee, and dem take care of am. Many oda women wey don follow am from Jerusalem sef dey for there.

As Dem Take Bury Jesus

42. Na Preparation Day (di day before Sabbath). So as evening don dey reach,

43. Joseph of Arimathea—man wey get levels among di senior-men—wey hinsef dey wait for Baba-God kingdom, naso he use full-mind waka go meet Pilate, con ask for Jesus body.

44. Pilate surprise wen he hear sey Jesus don already die. He call di sojas, con ask if Jesus don already die.

45. Wen di sojas tell am sey na true sey Jesus don die, he give Jesus body to Joseph.

46. So Joseph buy some linen cloth, he carry di body come down, wrap am wit di linen, con put am for grave inside rock. He con roll one stone cover di grave.

47. Mary Magdalene and Mary wey be Joseph mama see where dem bury Jesus put.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *