Luke Chapter 13

Abeg share

Repent Or Kpeme

  1. Now dem tell Jesus about some pipo from Galilee, wey Pilate kill—as dem dey give sacrifice for di worship-place.
  2. Jesus con ansa dem, “Abi una tink sey dis pipo from Galilee dey commit sin pass those oda pipo from Galilee—becos dem suffer like dis?
  3. I dey tell una, lai-lai! But unless una repent, all of una sef go kpeme.
  4. Abi una tink sey those eighteen pipo wey kpeme wen di tall-house for Siloam fall on top dem—bad pass all di oda pipo wey dey stay for Jerusalem?
  5. I dey tell una, lai-lai! But unless una repent—unasef go kpeme.”
  6. He con tell dem dis parable: “E get one man wey plant fruit tree for hin farm, and he con go fyne fruit for there, but he no see any fruit.
  7. Naso he tell di guy wey dey take care of di farm sey, ‘For three years now, I don dey come fyne fruit for dis fruit tree, and I neva see anytin. Cut am put for ground! Why e go dey waste di soil?’
  8. “Di guy con ansa am sey, ‘Oga, make you leave am for one more year, and I go dig round, con put manure.
  9. If e produce fruit next year, fine! If not, we go cut am for ground!’ ”

Di Cripple Woman Heal On Sabbath

10. On Sabbath day, Jesus dey teach for inside one of di worship-place,

11. And one woman wey bad-spirit don turn to cripple for eighteen year, dey for there. Her body don bend, and she no fit straight her body at all.

12. Wen Jesus see her, he call her come front, con tell her sey, “Woman you don free from your sickness.”

13. Naso he touch her body, and kia-kia, she straight her body. She con start to dey praise Baba-God.

14. Di ruler of di worship-place con dey vex becos Jesus don heal pesin on Sabbath day, so dem tell di pipo sey, “Six days nahin dey to hustle. So make una come make dem heal una for di six days, no be for di Sabbath day.”

15. So Jesus ansa am, “Fake-pipo! All of una no dey loose una donkey or malu from e cage, con carry am go drink water on Sabbath day?

16. Abi make dis woman wey be Abraham daughter, wey Satan don tie down for eighteen years, no free from wetin dey tie her down on Sabbath day?”

17. Wen he tok dis tins, shame con dey catch all di pipo wey dey against am, but body con dey sweet all di pipo—for di ogbonge tins wey Jesus do.

Di Parable Of Di Mustard Seed Plus Di Yeast

18. Jesus con ask, “Wetin I go use take compare Baba-God kingdom? Wetin e be like?

19. E be like mustard seed wey one man go plant for hin garden. E grow, con turn to tree, and birds wey dey fly for sky—con dey perch for e branch.”

20. He ask again, “Wetin I go use take compare Baba-God kingdom?

21. E be like di yeast wey one woman use take make bread. Even though she put only three measures of flour, e make di whole container of flour wey she mix—to rise.”

Di Small Door

22. Jesus waka pass di cities plus villages, he dey teach as he dey go Jerusalem.

23. Pesin con ask am, “Oga, na only some pipo go dey saved?” He con tell dem sey,

24. “Try well-well make you enta tru di small door. I dey tell una—becos plenty pipo go try to enta, but dem no go fit.

25. Once di owner of di house stand up—con lock di door, una go stand for outside, con dey knock—dey beg, ‘Oga, biko open di door for us.’ “But he go ansa, ‘I no know you, or where you come from.’

26. “Naso una go tok sey, ‘We follow you chop and drink, and you teach for awa streets.’

27. “But he go ansa, ‘I no know una or where una come from. Komot from my side all of una wey dey do evil tins!’

28. “Una go dey cry for there, con dey bite una teeth wit pain—wen una see Abraham, Isaac plus Jacob, plus all di prophets–for Baba-God kingdom, but dem go pursue una komot.

29. Pipo go come from east, plus west, and north, plus south, and dem go sidon for Baba-God kingdom.

30. True-true, some pipo wey be last—go be first, and di first—go con be di last.”

Jesus Feel Sad For Jerusalem

31. Dat very day, di Pharisees come meet Jesus, con tell am sey, “Komot from dis place. Herod wan kill you.”

32. He con ansa dem, “Go tell dat fox sey, ‘I go pursue your bad-spirits komot, con heal pipo today and tomorrow, and for di third day I go don finish my plan.’

33. But I must travel today and tomorrow, and di following day—surely no prophet fit die outside Jerusalem!

34. “Chai, Jerusalem, Jerusalem, una wey dey kill di prophets, con stone those pipo wey Baba-God send to una, e don tey wey I wan gada una pikin togeda, as fawo take dey gada her pikin under her feather, but una no gree!

35. See, una house don empty finish. I dey tell una sey, una no go see me again until una tok sey, ‘Blessings for di pesin wey come wit di name of Baba-God.’ ”

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *