Luke Chapter 18
Di Parable Of Di Widow Wey No Wan Gree
- Naso Jesus gist hin disciples one parable—to show dem sey make dem always dey pray, and no give up.
- He tok sey: “E get one judge for one town—wey no dey fear Baba-God,and wey no-send any-pesin.
- And e get one widow for dat town wey dey always come meet am—dey beg am sey, ‘Epp me get justice against my enemies.’
- “First-first, di judge no gree epp di woman. But las-las he con tell hinsef sey, ‘Even though I no dey fear Baba-God, and I no- send any-pesin,
- but becos dis widow no wan let me rest, I go make sure sey I settle her mata—so dat she no go make me taya—as she dey come here like dis!’ ”
- Jesus con tok sey, “Listen to wetin di corrupt judge dey tok.
- Abi una tink sey Baba-God no go bring justice for di pipo wey he don choose, wey dey cry to am day and night? Abi una tink sey he go just dey fashi dem everi time?
- I dey tell una sey, he go make sure sey he settle dem kiakia. But wen Man-pikin go show, una sure sey e go meet any-pesin wey still get faith—inside dis world?”
Di Parable Of Di Pharisee, Plus Di Tax Collector
9. Dis parable wey Jesus gist dem na for those pipo wey dey form sey dem holy, and wey dey carry shoulder up:
10. “Two men go di worship-place [church] go pray, one na Pharisee, and di oda one na tax collector.
11. Di Pharisee stand up con dey pray about hinsef: ‘Baba-God, I tank you sey I no be like oda men—robbers, evil doers, men wey dey climb pipo wife—or even like tax collectors.
12. I dey fast two times a week, and I dey give tithe of everitin wey I get.’
13. “But di tax collector stand far-far. He no fit even face heaven, but he nack hin chest con tok sey, ‘Baba-God sorry-for me, I be sinner.’
14. “I dey tell una sey—dis man go hin house as beta pesin [righteous man] for Baba-God eyes, instead of di Pharisee. Any-pesin wey dey feel big—go fall hin hand, and any-pesin wey humble hinsef—go get promotion.”
Di Small Pikin And Jesus
15. Pipo con dey carry small-small pikin come meet Jesus—make he touch dem. Wen hin disciples see wetin dey happun, dem no gree.
16. But Jesus call di small- small pikin come where he dey—con tok sey, “Allow di small-small pikin come meet me, and make una no stop dem, Baba-God kingdom belong to pipo wey be like dis pikin.
17. I dey tell una di truth, any-pesin wey no receive Baba-God kingdom like small-small pikin no go fit enta inside am.”
Di Ruler Wey Get Moni
18. One ruler ask Jesus, “Good teacher, wetin I must do to get life wey dey last forever?”
19. Jesus ansa am, “Why you dey call me good? No-pesin good—except Baba-God.
20. You know di commandments: ‘No sleep wit pesin wife, no kill pesin, no steal, no lie for pesin head, respect your papa and your mama.’ ”
21. Naso he tok sey, “I don keep all dis commandment since I be small boy.”
22. Wen Jesus hear am, he con tell am sey, “You still dey miss one tin. Sell everitin wey you get—make you give poor pipo, and you go get beta-beta-tins for heaven. Den make you come follow me.”
23. Wen he hear am, he feel sad—becos he get moni well-well.
24. Jesus look am—con tok sey, “E dey hard for bigman to enta Baba-God kingdom!
25. True-true, e easy pass for camel to pass tru di eye of niddle, dan make bigman enta Baba-God kingdom.”
26. Those pipo wey hear am con ask, “Who go con get salvation?”
27. Jesus ansa dem, “Baba-God fit do wetin men no fit do.”
28. So Peter tell am sey, “We don fashi everitin wey we get—con dey follow you!”
29. Naso Jesus tell dem sey, “I dey tell una di truth, no-pesin wey don leave house, or wife, or brodas, or papa and mama, and pikin becos of Baba-God kingdom—
30. wey no go receive wetin plenty pass dis tins—for dis generation, plus everlasting life—for di generation wey go come.”
Jesus Predict Hin Death Again
31. Jesus carry di twelve disciples go one side, con tell dem sey, “We dey go Jerusalem and everitin wey di prophets tok about Man-pikin go come to pass.
32. Dem go carry am give world-pipo. Dem go yab am, insult am, spit for hin body.
33. Dem go flog am, con kill am. And He go raise up again on di third day.”
34. Di disciples no understand anytin wey he tok. Dem no know wetin e mean, and dem no know wetin he dey tok about.
Di Blind Beggar Start To Dey See Again
35. As Jesus dey reach Jericho, one blind man sidon for corner of di road—dey beg.
36. As he hear di plenty- pipo wey dey pass, he ask dem wetin dey happun.
37. Dem con tell am sey, “Jesus of Nazareth dey waka pass.”
38. Naso he start to dey shout, “Jesus, Son of David, sorry-for me!”
39. Those pipo wey dey for front con change-am-for am, dem tell am sey make he sharrap, but he con dey shout more-more, “David Pikin, sorry-for me!”
40. Jesus stop, con tok sey make dem carry di man come. Wen di man reach where he dey, Jesus ask am sey,
41. “Wetin you wan make I do for you?” Di man con tok sey, “Oga, I wan make my eyes open.”
42. Jesus con tell am sey, “Oya, open your eyes; your faith don heal you.”
43. Sharp-sharp, he start to dey see, he follow Jesus, con dey praise Baba-God. Wen all di pipo see wetin happun, dem sef praise Baba-God.