Di Son Wey Get Levels Pass Angels
- Before-before, Baba-God use prophets follow awa papa-papa-papa tok many times, and wit different ways,
- but for dis last days he use hin Son follow us yarn. Na him Baba-God use take make di world and Baba-God don choose am—to take over everitin.
- Di Son dey shine wit Baba-God levels [glory], and nahin be di fotocopy of Baba-God, and he dey maintain everitin wit di pawa of hin word. Afta he don wash awa sins komot by hinsef, he sidon for di right hand of Baba-God—wey get levels as King for heaven.
- So he con get plenty levels pass di angels, as di name wey Baba-God give am, get levels pass dem.
- Which of di angels Baba-God ever tell sey, “You be my Son; today I go be your Papa”? Or “I go be hin Papa and he go be my pikin”?
- And again, wen Baba-God bring hin first born enta dis world, he tok sey, “Make all Baba-God angels worship am.”
- Na wetin he tok about di angels be dis, “He make hin angels like spirits, and hin servants like faya wey dey burn.”
- Na wetin he tok about di Son be dis, “Oh God, your king-chair go last for ever and ever, and justice go be di staff of your kingdom.
- You love goodness, con hate wickedness; so Baba-God your God—don choose and anoint you wit di ororo of happiness—pass everi of your mate.”
- He still tok sey, “Oh Oga, from di starting you set di foundations of di earth, and di heavens na your hand work.
- Dem go scata, but you go still dey; dem go fade like cloth.
- You go fold dem like cloth; you go change dem. But you always dey di same, and you go live forever.”
- Which of di angels Baba-God ever tell sey, “Sidon for my right hand—until I put your enemies under your leg like stool.”?
- Abi all angels no be spirits wey Baba-God send to take care of those pipo wey Baba-God go give salvation?
Post Views: 50