1st John Chapter 1

Abeg share

Di Word of Life

  1. Wetin don dey from di starting, wey we don hear, wey we don see wit awa korokoro eyes, wey we don observe, and wey awa hand don hold, about di word of life.
  2. Di life show-face, and we don see am, we tok about am, and we preach to una about dat everlasting life—wey dey wit di Fada, and wey show-face to us.
  3. We dey tell una wetin we don see, and wetin we don hear—so dat una fit rub-mind wit us. And true-true, we dey rub-mind wit di Fada, and hin Son—Jesus Christ.
  4. We dey write dis tins to you—so dat your happiness go yanfu-yanfu.

To Dey Live Inside Di Light

5. Dis na di message wey we don hear from Jesus— con tell una: Baba-God na light, and darkness no dey for inside am at all.

6. If we claim sey we dey run tins wit Baba-God, and we still dey waka inside darkness, we dey lie and we no dey follow di truth.

7. But if we dey waka inside di light as Baba-God take dey inside di light, we dey rub- mind wit each oda, and di blood of Jesus—hin Son, go clean us from all sins.

8. If we claim sey we no get sin, we dey whyne awasef, and di truth no dey inside us.

9. If we confess awa sins, he dey faithful—and he go use hin church-mind forgive awa sins, con clean us from everi evil ways.

10. If we claim sey we neva commit sin, we mean sey Baba-God dey tok lie, and hin word no dey inside us.

Questions about 1st John Chapter 1

What is 1st John Chapter 1 in Pidgin Bible?

This page contains 1st John Chapter 1 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/1st-john-chapter-1/

Where can I read 1st John Chapter 1 in Nigerian Pidgin?

You can read 1st John Chapter 1 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/1st-john-chapter-1/

Which Bible book contains 1st John Chapter 1?

1st John Chapter is the Bible book identified by this reference.

What chapter is 1st John Chapter 1?

The chapter identified by this reference is 1.

Topics connected to this passage

  • Forgiveness

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now