- From di senior-man. To di madam wey dem choose, plus her pikin, wey I love inside truth—and no be only me, but everi-pesin wey don sabi di truth—
- becos of di truth wey dey live inside us, and wey go dey wit us forever:
- Make grace, mercy plus peace from Baba-God di Fada, and from Oga Jesus Christ—di Son of di Fada, kontinu to dey wit us for inside truth, and love.
- My belle dey sweet me well-well sey some of your pikin don dey waka inside truth just as di Fada sey make we dey do.
- Abeg madam, I no dey write you new command, but na di one wey we don know from starting—sey make we love one anoda.
- Na love be dis: to obey wetin Baba-God tell us to do. Dis na wetin he command, sey as you don hear from di starting, dey waka inside am.
- I dey tok dis one becos, many wayo-pipo wey no gree sey Jesus Christ come as human being—don go inside di world. Dat kain pesin na wayo-pesin and antichrist.
- Shine your eyes so dat we no go lose those tins wey we don hustle for, but make we receive full blessings.
- Any-pesin wey commit sin and wey waka komot from di teaching of Christ, no get Baba-God inside am; any-pesin wey kontinu inside di teaching, get both di Fada, plus di Son.
- If any-pesin come meet you, and he no carry dis teaching come, no let am enta your house, and no greet am.
- Any-pesin wey greet am—dey share inside hin evil work.
- I get plenty tins to write to you, but I no wan use paper and ink. Instead, I hope to come visit una, and follow una tok face to face—so dat awa happiness go complete.
- Greeting from di pikin of una sista —wey Baba-God don choose. Amen.
Post Views: 49