Revelation Chapter 13

Abeg share

Beast [wild animal] Wey Komot From Di Water

  1. I stand for di beach. And I con see di beast [wild animal] dey rise up from di big-river. He get seven heads, plus ten horns, wit ten crowns for hin horns, and e get name wey dey bad-mouth Baba-God for all hin head.
  2. Di beast [wild animal] wey I see resemble leopard, but e leg con be like bear leg, and e mouth be like lion mouth. Di dragon give di beast [wild animal] hin strength and hin king-chair, plus ogbonge pawa.
  3. I see sey one of di head of di beast [wild animal]—as if e bin get serious wound, but di serious wound don heal. Di whole world surprise, con dey follow di beast [wild animal].
  4. Men worship di dragon wey don give di beast [wild animal] pawa, dem worship di beast—and dem con dey tok sey, “Who fit be like di beast [wild animal]? Who fit fight war against am?”
  5. Dem allow di beast [wild animal]  to tok plenty ogbonge tins, and to bad-mouth Baba-God, and to show e pawa for forty-two months.
  6. He open hin mouth to bad-mouth Baba-God, and to bad- mouth hin name, and where he dey stay, and those pipo wey dey live for heaven.
  7. Dem give am pawa to fight war against God-pipo, and to conquer dem. And dem give am pawa to control everi tribe, pipo, language and nation.
  8. Everi-pesin wey dey stay for earth go worship di beast [wild animal] —any-pesin wey dem no write hin name for di Book of Life—wey belong to di Lamb wey dem kill from di beginning of di world.
  9. Any-pesin wey get ears, make e hear.
  10. Pesin wey go go prison—go-go prison, and pesin wey go die by sword—go die by di sword. Nahin be sey make God-pipo dey patient, and get faith.

Di Beast [wild animal] Wey Come Out From Di Earth

11. I con see anoda beast  [wild animal] wey dey come out from di earth. E get two horn like lamb, but e con dey tok like dragon.

12. He use all di pawa wey di first beast [wild animal]  give am to use for am, and he con make all di pipo wey dey stay for earth worship di first beast [wild animal] wey get wound wey don heal.

13. And e perform ogbonge miracles, sote e even make faya come down from heaven to earth—make men see.

14. Becos of di miracles wey di beast [wild animal] let am do for hin front, e scam di pipo wey dey stay for di earth. He sey make dem make image to honour di beast [wild animal]  wey bin wound wit sword—but wey still dey alive.

15. E con get pawa to give life to di image of di beast [wild animal], sote e con dey tok, and make dem kill all di pipo wey no gree worship di image.

16. E use gra-gra for everi-pesin—small or great, rich or poor, free and slave, to collect mark for dia right hand, or on dia forehead,

17. so dat no-pesin fit buy or sell—unless e get di mark, wey be di name of di beast, or di numba of  hin name.

18. Dis one mean sey make everi-pesin use wisdom. Make any-pesin wey fit understand calculate di numba of di beast, na di numba of man. Hin numba na  666.

Questions about Revelation 13

What is Revelation 13 in Pidgin Bible?

This page contains Revelation 13 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/revelation-chapter-13/

Where can I read Revelation 13 in Nigerian Pidgin?

You can read Revelation 13 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/revelation-chapter-13/

Which Bible book contains Revelation 13?

Revelation is the Bible book identified by this reference.

What chapter is Revelation 13?

The chapter identified by this reference is 13.

Topics connected to this passage

  • Faith
  • Wisdom
  • Strength
  • Money
  • Healing
  • Worship

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now