Deuteronomy Chapter 26

Abeg share

Offering of Firstfruits Plus Tithes

  1. Wen una enta inside di land wey Baba-God dey give  una as una property forever, and una claim di land, con dey live for there,
  2. Make una carry some of di first food wey ua harvest from di ground, wey una go carry from di land wey Baba-God dey give una, make una put am inside basket, con carry am go di place wey Baba-God una Oga go choose for hin name to stay.
  3. And una go go meet di pesin wey be di priest of una days, con tell am sey, “I dey tok am today for Baba-God your Oga, sey I don enta di kontri wey Baba-God swear to awa papa-papa-papa to give us.’
  4. Naso di priest go collect di basket from una hand, con put am down for front of di altar of Baba-God  una Oga.
  5. And una go ansa, con tok for Baba-God front sey: “My papa [Jacob] na Syrian wey don waka taya, and he go Egypt [wit hin family], con stay for there, dem bin no plenty; but na for there dem turn to nation, ogbonge pipo wit pawa, wey plenty well-well.
  6. But di pipo of Egypt do us anyhow, dem show us peper, and dem give us hard work.
  7. So we cry to Baba-God wey be di Oga of awa papa-papa-papa, he hear awa voice, he look awa suffer-head, and awa hard work, and how dem dey show us pepper.
  8. So Baba-God carry us komot from Egypt wit strong hand and wit hin hand wey stretch out, wit serious gbege, and wit miracle signs plus wonders.
  9. He don carry us come dis place, con give us dis  land, ‘Land wey dey flow wit milk plus honey’,
  10. And now, see, I don bring di firstfruits of di land wey you give me, oh Baba-God.” Naso you go put  am for front of Baba-God, con worship Baba-God your Oga.
  11. So you go happy for everi beta tin wey Baba-God don give you plus your family, una plus di Levites  and di strangers wey dey live among una.
  12. Wen una don separate all di tithes of una harvest for  di third year—di year of tithes—and una don give dem to di Levite, di strangers, pipo wey no get papa, widows, so dat dem go fit chop for una city, con even belleful,
  13. Den una go tok dis tin for Baba-God una Oga front: ‘I don komot di holy tithe from my house, and I don give dem to di Levites, di strangers, pipo wey no get  papa, and widows, based-on wetin you tell us to do; I neva turn komot from wetin you tell us to do, and I neva fashi dem.
  14. I neva chop any one of dem wen I dey mourn, or komot from any one of dem to do sometin wey no clean, or give any of dem for dead pesin. But I don obey Baba-God voice, and I don do everitin based-on wetin he tell me.
  15. Look down from di holy place wey you dey stay, from heaven, con bless your pipo Israel plus di land wey you don give us, just as you bin swear to awa papa-papa-papa, ‘Land wey dey flow wit milk plus honey.’”

     Baba-God Special Pipo

16. “Na dis be di day wey Baba-God una Oga dey tell  una to keep hin words and hin laws; so make una  calm down to keep dem and do dem wit all una heart and soul.

17. Una don tell Baba-God today sey na him be una God, and una go waka for hin way, con keep hin laws, plus hin words, and hin commandments, and to listen to hin voice.

18. Baba-God don tok am today sey na una be hin special pipo, just as He promise una, and sey una  go keep all hin laws.

19. And sey he go carry una go up pass everi nation wey he don make, for praise, for name, and for levels; and una go be holy pipo for Baba-God una  Oga, just as he don tok.”

Questions about Deuteronomy 26

What is Deuteronomy 26 in Pidgin Bible?

This page contains Deuteronomy 26 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/deuteronomy-chapter-26/

Where can I read Deuteronomy 26 in Nigerian Pidgin?

You can read Deuteronomy 26 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/deuteronomy-chapter-26/

Which Bible book contains Deuteronomy 26?

Deuteronomy is the Bible book identified by this reference.

What chapter is Deuteronomy 26?

The chapter identified by this reference is 26.

Topics connected to this passage

  • Strength
  • Family
  • Guidance
  • Worship
  • Obedience

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now