• Exodus Chapter 38

    Di Altar For Offering Wey Dem Burn Di Basin For Washing 8. He use bronze take make basin plus basin-stand, wit bronze mirrors wey di women give—di women wey dey serve for di doormot of di worship-place. Di Yard For Di Worship-place 9. He form di yard wey dem use curtains take cover, curtains wit fine linen wey dem weave. Di curtain long reach 150 feet for di south side. 10. Na twenty pillars hold di curtains, wit twenty solid-bottoms wey dem make wit bronze. And wit silver hooks and rings for di pillars. 11. He make di same type of curtains for di north side—wey long reach 150 feet.…

  • Exodus Chapter 39

    As Dem Take Make Clothes For Di Priests As Dem Take Make Di Priest-cloth 2. Bezalel use gold take make di priest cloth, and blue, purple plus red thread, and dem use fine linen cloth wey dem weave. 3. Dem hammer thin sheet of gold, dem cut am like thin threads, con weave am togeda wit di blue, purple and red thread, plus di fine linen—na di work of designer wey get skill. 4. Dem make shoulder parts for di priest-cloth—wey dem join for di two corners, so dat dem fit tie am. 5. Di belt wey dem weave wit skill for di priest-cloth na di same materials wit di…

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now