• Joshua Chapter 10

    Di Sun No Gree Move Dem Kill Five Amorite Kings 16. So di five kings run, con hide inside rock for Makkedah. 17. Naso dem gist Joshua sey, “Dem don see di five kings dey hide for inside rock or Makkedah.” 18. So Joshua tok sey, “Make una roll big stone for di mouth of di rock, and put some men for there wey go dey guard am. 19. But make una no stop! Pursue una enemies, attack dem from back. No give dem chance to enta dia cities, becos Baba-God una Oga don make una win dem.” 20. So Joshua plus di pipo of Israel scata dia enemies kpatakpata—sote…

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now