Blog

Your blog category

  • 1st Kings Chapter 7

              Solomon Build Hin Palace Di Bronze Pillars For Baba-God House 15. Huram make two bronze pillars, everi single one of dem tall reach 27 feet, and round di body of di pillar na 18 feet. 16. He use bronze take make two caps for pillars—wey he go put on top of di pillars. Di caps na seven and half feet. 17. He design di cap of everi pillar wit chains wey dem weave and net-design; seven chains for one cap-of-pillar, and seven for di oda cap-of-pillar. 18. So he make di pillars, plus two rows of pomegranates round on di net-design, to design di cap-of-pillar wey dey up of…

  • 1st Kings Chapter 8

    Dem Carry Di Ark Go Baba-God House Solomon Prayer For Baba-God House 22. Naso Solomon stand for front of Baba-God altar, for front of di whole pipo of Israel wey gada togeda, he spread hin hands face heaven, 23. con tok sey: “Oh Baba-God, God of Israel, no God be like you for heaven wey dey up, or for earth wey dey ground—you wey dey keep your agreement plus mercy—wit your servants wey dey serve you wit dia whole heart. 24. You don keep your promise to your servant David my papa, you don promise wit your mouth and you don use your hand take do am—as e be so…

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now