Blog

Your blog category

  • Psalm Chapter 119

    Baba-God Law (Aleph) 2. Blessings for those wey dey keep Baba-God commandment, wey dey fyne am wit all dia heart. 3. Dem no dey do wrong tin; dem dey waka for hin way! 4. You don command us to keep your law wit seriousness. 5. Oh, I wish sey na you dey direct me to keep your laws! 6. So shame no go catch me wen I dey reason all your commandments. 7. I go praise you wit clean-heart, as I dey learn your good judgements. 8. I go obey your law; no fashi me kpatakpata. Beth 9. How young pesin fit take keep hin way pure? Na by living…

  • Psalm Chapter 120

    A Prayer For Freedom 2. Oh Baba-God, save me from pipo wey dey tok lie, and save me from wayo tongue. 3. Chai wayo mouth, wetin you go receive, or wetin Baba-God go do you? 4. Sharp arrow of warrior, plus coals of broom tree! 5. Kasala for me, if I stay for Mesech, sey I dey live among di tents of Kedar! 6. E don too tey wey I dey stay wit pipo wey no like peace. 7. I be man of peace; but wen I tok, dem wan fight me.

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now