Blog

Your blog category

  • Ezekiel Chapter 28

    Prophecy Against Di King of Tyre Cry For Di King Of Tyre 11. Naso Baba-God word come meet me, sey, 12. “Man pikin, sing dis burial song for di king of Tyre. Tell am sey, ‘Dis na wetin Baba-God Almighty tok: “You bin dey like di example of sometin wey perfect You brekete wit wisdom, and di way you bin fine na elele. 13. You bin dey for Eden, Baba-God garden; everi fine-fine-stone cover you: sardius, topaz, plus diamond, beryl, onyx, jasper, sapphire, emerald, plus carbuncle, and gold: your sheke-sheke and your flutes don ready for di day wey dem make you. 14. I choose you and I anoint you…

  • Ezekiel Chapter 29

    Prophecy Against Egypt Nebuchadnezzar Go Win Egypt 17. E con happun sey, for di twenty seventh year [as Jehoiachin be prisoner], for di first month, for di first day of di month, Baba-God word come meet me, sey: 18. “Man pikin, Nebuchadnezzar di king of Babylon don make hin army work well-well to fight against Tyre—sote everi head turn to gorimakpa and everi shoulder peel, but him plus hin army no gain anytin from Tyre wit di kain energy wey dem spend for there against Tyre [becos dem still no fit win dem]. 19. So dis na wetin Baba-God Almighty tok: ‘I go surely give Egypt to Nebuchanezzar wey be…

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now