Blog

Your blog category

  • Psalm Chapter 121

    Epp Dey Come From Baba-God 2. My epp dey come from Baba-God—wey make heaven plus earth. 3. He no go let your leg shake, pesin wey dey watch you no dey sleep; 4. True-true, pesin wey dey watch Israel no go crash or sleep. 5 . Baba-God dey watch you—Baba-God na your shade for your right hand. 6. Di sun no go wound you for day, or di moon for night. 7. Baba-God go keep you from evil—he go save your soul; 8. Baba-God go keep you wen you dey komot, and wen you dey come back—both now and forever.

  • Psalm Chapter 122

    Jerusalem 2. Awa leg don dey stand inside your gates, oh Jerusalem. 3. Dem build Jerusalem as city wey di pipo dey togeda. 4. Na for there di tribes of Baba-God dey gada put, to praise Baba-God name based-on di law wey he give Israel. 5. Na for there di king-chair of judgement stand put, di king-chairs of di house of David. 6. Pray make peace dey for Jerusalem; “Make those pipo wey love you prosper.” 7. Make peace dey inside your walls, and make prosperity dey for your palaces.” 8. Becos of my pipo and padi, I go tok sey, “Make peace dey around you” 9. Becos of di…