Psalm Chapter 122

Abeg share

Jerusalem

  1. Dis na song of rising. I happy wen dem tell me sey, “Make we go Baba-God house.”

2. Awa leg don dey stand inside your gates, oh Jerusalem.

3. Dem build Jerusalem as city wey di pipo dey togeda.

4. Na for there di tribes of Baba-God dey gada put, to praise Baba-God name based-on di law wey he give Israel.

5. Na for there di king-chair of judgement stand put, di king-chairs of di house of David.

6. Pray make peace dey for Jerusalem; “Make those pipo wey love you prosper.”

7. Make peace dey inside your walls, and make prosperity dey for your palaces.”

8. Becos of my pipo and padi, I go tok sey, “Make peace dey around you”

9. Becos of di house of Baba-God awa Oga, I go hustle for you to prosper.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now