Blog

Your blog category

  • Psalm Chapter 139

    Baba-God Dey Everi Where, And He Know Everi- everi 2. You sabi wen I sidon, and wen I stand up; you sabi wetin I dey tink about from far-far. 3. You know my waka, and wen I dey lie down for bed; you sabi all my ways. 4. You sabi wetin I wan tok before I even tok am. 5. You guard me for back and front; you lay your hand on me. 6. E dey blow my mind—as I know dis tins,e too high, my head no-fit carry am. 7. Where I fit waka komot from inside your Spirit! Where I fit run go wey you no go dey?…

  • Psalm Chapter 140

    Freedom From Pipo Wey Dey Show Me PepperBecos Of Baba-God 1. For di producer of music. Dis na Psalm of David. Oh Baba-God, save me from evil men; protect me from men wey like fight fight, 2. men wey dey plan evil for dia heart, and wey dey always gada togeda for war. 3. Dem sharp dia tongue like snake. Snake poison dey drop from dia lips. 4. Oh Baba-God, guard me from di hands of wicked pipo. Protect me from men wey like to shed blood, wey don dey plan to make me fall. 5. Men wey dey buga don set trap for me, plus ropes; dem don spread…