- O Lord, you don look inside my heart and you know me.
- You know wen I sidon and wen I stand up; you dey smell wetin I dey think
about fom far.
- You know when I dey go out and when I dey lie down for bed; you know all
my ways.
- You know wetin I wan talk before I even talk am.
- You guard me for back and front; you don use your hand cover me.
- E dey burst my head, e too dey wonderful for me.
- Whwre I fit waka comot go from your spirit? Where I fit run comot go from
your presence?
- If I go up for heaven, you dey there; if I go sleep inside hole, you dey there.
- If I wake up for morning, come travel to far-far inside sea,
- Even for dat side, your hand go guard me. Your right hand go hold me fast-
fast.
- If I sey, “I fit hide inside darkness and di light around me go turn to night,”
- Even di darkness no go dey dark to you; di night go hine like di day,
darkness go be light to you.
- Na you create di deep sid of me, you join me together for inside my mama
belle
- I praise you becos I dey sacred and you make me wonderful; your works dy
wondful, I know dat one wella.
- You see my skeleton wen I you dey form me inside secret. When you join
me together for inside the earth,
- you see my body as e dey form. You don write all di day wey I go live for dis
earth inside book even before di day go happun.
- Di thought of you dey precious to me O Babagod. Plenty things wey to think
about you.
- If I wan count dem, dem go pass sand-sand. When I wake up, I still dey wth
you.
- If you fit pkuff wicked men comot from where I dey O God! Pkuff men wey
like blood comot from where I dey.
- Dem talk about you with bad mind; your enemies dey use your name play.
- O God, abi you think sey I no hate pipo wey hate you, or hate pipo wey wan
fight you?
- Na only hatred I get for dem. I dey count dem as my enemies.
- Sapka me O God make you know my heart;
- Tet my make you know wetin me make my blood rush.
- Look if any thing wey no dey good dey inside me and lead me for di way
wey last forever.
Post Views: 18