Psalm Chapter 140

Abeg share
  1. For di producer of music. Dis na Psalm of David. Oh Baba-God, save me from evil men;
    protect me from men wey like fight-fight,
  2. men wey dey plan evil for dia heart, and wey dey cause war everi day.
  3. Dia tongue sharp like snake mouth. Snake poison dey drop from dia lips.
  4. Oh Baba-God, guard me from di hands of di wicked pipo. Protect me from men wey like
    blood, dem dey plan to make me fall.
  5. Men wey dey buga don set trap for me; dem don spread di rope of dia net for me, and dem
    don set trap for where I dey waka pass.
  6. Oh Baba-God, I tok sey, “Na you be my God.” Hear my cry for mercy Oh Baba-God.”
  7. Oh Baba-God wey get full control, my strong saviour—wey dey cover my head wen fight dey.
  8. Oh Baba-God, no give wicked pipo wetin dem dey fyne; no let dia plan succeed, or dem go
    dey make-mouth.
  9. As for di head of those pipo wey surround me, make di wahala wey dey dia mouth cover
    dem.
  10. Make hot faya fall for dia head. Make dem fall inside faya, make dem fall inside hole of
    portor-portor—and make dem no fit stand up again.
  11. Make pipo wey get bad-mouth no stand gidigbam for di land; make yawa pursue pipo wey
    like blood.
  12. I know sey Baba-God go give justice to poor pipo, and fight for pipo wey no get shi-shi.
  13. Surely righteous pipo go praise your name, and di pipo wey get clean heart go stay wit you.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *