Hosea

  • Hosea

    Hosea Chapter 14

    Message For Dem To Repent Oh, Israel, make una come back to una God, becos una sins don make una fall yakata. Bring your words of confession, and turn back to Baba-God. Tell am sey, “Carry all di sins komot, so dat we go fit praise you wit awa lips. Assyria no go save us; we no go ride horses for war; and we no go ever tell di idols wey we make wit awa hand, sey, ‘Na you be awa God.’ Na you dey sorry-for pipo wey no get papa and mama.” Di Promise of Baba-God Blessing 4. I go heal dem as dem turn komot from me; I…

  • Hosea

    Hosea Chapter 13

    Ephraim Levels Don Komot Wen Ephraim tok, everi where dey shake; he bin get levels for Israel. But di pipo of Ephraim commit sin by worshipping Baal [idols], naso dem con dey kpeme. Now dem dey sin more-more, con make image wey dem cast wit silver. Dem design idols wit dia hand; all of dem na di work of artist. Pipo dey tok about dem sey, “Make di men wey dey sacrifice kiss di idol wey be like small-malu (to show respect)!” So dem go be like di morning cloud, like di dews for early mor-mor wey dey pass komot. Dem go be like chaff wey dem blow komot from…

  • Hosea

    Hosea Chapter 12

    Baba-God Change-am-for Ephraim, Judah, plus Jacob Ephraim dey pursue breeze, and he pursue di east breeze; day by day, he dey lie more-more and na scata-scata full hi hand; he dey make agreement wit Assyria, con send ororo go Egypt (becos dem wan try to be Egypt padi). Baba-God get mata against Judah. He go punish Jacob for hin ways, he go punish am based-on wetin he don do. He hold hin broda leg for inside hin mama belle, and he fight wit Baba-God wit hin pawa. Yes, he fight wit angel and he win; he cry and he ask for hin favour. And na for Bethel Baba-God take meet…

No copy from dis website