Hosea Chapter 3

Abeg share

Israel Go Go Back To Baba-God

  1. Naso Baba-God tell me sey, “Go show your wife love again, even though anoda pesin love her, and she be ashawo. Love her just as Baba-God take love Isreal, even though dem dey turn follow oda gods, con love dia cake of dry-grapes (wey dem dey use for dia idol worship).
  2. So I buy her wit fifteen silver coins, plus 150 kilograms of barley (di price wey dey dey sell ordinary slave).
  3. Naso I con tell her sey, “You must live wit me for many days; you must no dey waka follow men or belong to anoda man, and I go do di same tin for you.”
  4. Di pipo of Israel must live for many days wit no king, or prince, wit no sacrifice, wit no image, and wit-no priest-cloth or house-idols.
  5. Las-las, di pipo of Israel go come back to fyne Baba-God wey be dia Oga, and king David wey be dia king. And dem go fear Baba-God and hin goodness for di last days.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now