Hosea Chapter 8
Israel Go Harvest Rolling-breeze
- “Sound di alarm! Di enemy dey come down like eagle on Baba-God pipo, becos dem don break my agreement, and dem don turn from my law.
- Now Israel go beg me sey, ‘Awa God, we know you!’
- Di pipo of Israel don fashi beta tin, and now dia enemies go pursue dem.
- Di pipo choose king wit-out asking me, and dem choose princes wit-out asking me. Dem make idols for demsef wit dia silver and dia gold, dem don scata demsef wit dia own hand.
- Oh Samaria, I don reject di small-malu—dis idol wey una don make. I dey vex for dem like faya. How long e go take una to get clean-heart?
- Dis idol (small-malu wey dem mold) wey una worship, oh Israel, na una hand make am! No be Baba-God! So di idol (small-malu wey dem cast) of Samaria must scata to pieces.
- Dem don plant breeze, and dem go harvest rolling-breeze. No seed dey grow for di branch, e no go fit produce fruit. And even if e get fruit, na foreigners go swallow am.
- Dem don swallow di pipo of Israel; dem don scata among di nations—like old container wey dem don throway.
- Like wild donkey wey dey waka alone, dem don go Assyria. Di pipo of Israel don pay plenty kontris to support dem (dem pay plenty lovers).
- Even though dem pay nations to support dem, I go gada dem togeda con punish dem. Naso dem go suffer small becos di oppression of di king of princes [di king of Assyria].
- Even though Ephraim don build plenty altars for sin offerings, dem don turn di altar to place where dem dey commit sin!
- Even though I bin give dem all my laws, dem dey behave like sey those laws no dey affect dem.
- Di pipo like to dey give sacrifices to me, and to dey chop di meat, but I no gree accept dia sacrifices. I go remember dia wickedness, con go punish dem for dia sins: dem go go back to Egypt.
- Israel don forget who make am, and dem don build worship-place, and Judah don make e cities strong wit walls. So I go send faya put for di cities, and I go burn dia palaces.”